BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

How NDLEA catch one socialite wey dem allege na drug baron

55628506 Ademola Kazeem

Mon, 14 Nov 2022 Source: BBC

Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) say dem don track down and arrest Ademola Kazeem.

Dem accuse am of drug trafficking.

Na on 1 November , dem declare am wanted afta im no come wen NDLEA invite am to dia office and e no obey follow up order from federal high court for Lagos.

For statement wey di agency release on Sunday, Femi Babafemi reveal say di agency gbab am on November 10.

Dem say e dey custody wey im dey undergo interview.

NDLEA say dem find out im get hand for inside drug trafficking afta one Lagos BRT driver wey bin dey work as im mule open im bum-bum afta dem arrest am.

Dem say, "im cover open afta di arrest of one Bolujoko Muyiwa Babalola wey be BRT driver on 27th June for Murtala Muhammed International Airport, MMIA, Ikeja wia im reveal say na Alhaji Ademola Kazeem, alias Adekaz get di 900 grams cocaine wey bin dey im bodi".

Di suspected kingpin dey linked as di sponsor of some traffickers wey di agency arrest as dem bin dey try export cocaine go Dubai, UAE and oda destinations outside Nigeria.

Before di arrest on Thursday, di agency reveal say dem go court to:

- seal im identified properties for Lagos Island and Ibadan

  • declar am as wanted

    - Block im bank account wey get N217m inside

    - Before im arrest Alhaji Ademola bin dey known as Lagos socialite wet bin own di Adekaz hotel.

  • Source: BBC