BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Helicopter don crash for Lagos

Di wreckage of di crash

Tue, 1 Aug 2023 Source: BBC

One helicopter don crash for Ikeja area of Lagos for Nigeria.

Details never too clear about di crash but e be like say na private helicopter.

For di pictures and video wey dey circulate ontop social media, pipo gada around di remains of di helicopter while fire fighters dey quench di fire.

Meanwhile, authorities don confam to BBC Pidgin say one unidentified helicopter crash for Ikeja.

Emergency responders dey on ground and dey work for di scene for di accident.

Wen BBC Pidgin tok to di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA), tok-tok pesin, Nosa Okunbor tok saydia officials dey on ground.

Our eyes still dey dis tori wey dey break. Continue to dey refresh for more.

Source: BBC