BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Highlights of President Tinubu Democracy Day Speech to mark June 12

46036013 President of Nigeria, Bola Tinubu

Mon, 12 Jun 2023 Source: BBC

President Bola Tinubu don address Nigerians to commemorate di kontri Democracy Day wey dem dey mark on June 12.

For di speech wey last for 15 minutes, di president touch on di issue of di removal of fuel subsidy wey e announce on im inauguration day for May 29.

"Di removal of Fuel subsidy na sake of to free up money wey a few rich dey pocket, I admit say di masses go get extra burden, I feel your pain but dis na one decision we must bear so our kontri no go go under."

“Painfully I dey ask you my kontri men to sacrifice a little more for your kontri, I assure you say your sacrifice no go dey in vain. My administration go pay you back in building infrastructure's.

President Tinubu also assure Nigerians say im administration no go tolerate executive orders wey dem dey use take truncate - stop - democracy.

E also add say reforms to make di kontri beta just start.

For im speech, Nigeria President Bola Tinubu also hail di heroes of democracy wey die in di course of di struggle.

We still dey update dis tori.

Source: BBC