Some pipo stand, odas sidon for floor to watch chef Hilda Baci cook di biggest pot of jollof
Guinness World Records don confam Hilda Baci attempt for largest serving of Nigerian style jollof rice.
Dis dey come afta thousands of Nigerians on Friday 12 September bin gada for Lagos, southwest Nigeria, to watch as di former Guinness World Record holder and food influencer cook di biggest eva pot of jollof rice in di world.
Jollof rice na food wey dey popular for Nigeria, Ghana, Senegal, Sierra Leone, Liberia, among odas.
According to Guinness World Records on Monday 15 September 2025, dem say Hilda Bacci achieve di largest serving of Nigerian style jollof rice.
Hilda wey be 28-year-old bin gain global recognition for 2023 afta she break Guinness World Record for di longest cooking marathon, (individual), wit a time of 93 hours 11 minutes.
"New record: Largest serving of Nigerian style jollof rice - 8,780 kg (19,356 lb 9 oz) achieved by Hilda Baci," Guinness World Records post for dia X page.
Hilda tell BBC News Pidgin say di reason why she attempt to make di record na bicos "Naija no dey carry last."
"Na we be di giant of Africa, and jollof na food wey evribodi sabi Africans for. I kon tink am say as di giant of Africa and say our jollof mad, e go make sense if we get di biggest pot of jollof rice, e go dey nice for we kontri."
Dis na di first time pesin go try to cook di largest ever pot of jollof.
As hashtag #HildaBaci and #GuinessWorldRecord trend for social media, crowds, especially di Gen Zs, millennials, food lovers, vendors and celebrities gada for di venue to show dia support for Hilda Baci.
New record: Largest serving of Nigerian style jollof rice - 8,780 kg (19,356 lb 9 oz) achieved by Hilda Baci and Gino in Victoria Island, Lagos, Nigeria ๐ณ๐ฌ pic.twitter.com/ErJLEJR5Qr
โ Guinness World Records (@GWR) September 15, 2025
Di giant custom-made pot get capacity of 22,619 litres