BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

How Banky W skin cancer journey take waka as e finally declare victory

Screenshot 2024 05 24 101535.png Nigerian singer Banky W for hospital afta im fourth successful cancer surgery

Thu, 23 May 2024 Source: BBC

Nigerian singer Banky W wey im real name be Bankole Wellington don announce say im don successfully undergo im fourth cancer surgery.

For im Instagram page Banky W on Thursday share one long post wit title “Final scores - Christ 4 – Cancer Tumors 0.”

Dis go be di popular singer anoda successful surgery afta seven years.

Oga Wellington bin thank im wife, Adesua Etomi, wey also dey im side for di hospital as di video show – Banky urge im fans to get faith in God.

“Sometimes, your faith in God no go prevent di storms from coming… but e go carry you through dem. Faith no go always stop you from hurting, but e go help you heal, and e go help you deal.”

“God neva tok say di weapons no go form, E promise say dey no go prosper. E neva tok say di enemy no go come… E promise say wen di enemy come in like flood, di Spirit of God go raise standard against am.

Banky W further tok say im post dis testimony to encourage anyone out there wey dey go through one challenge.

E say e fit be It like say e big pass you, but greater be dat wey dey inside you than anytin you go face for dis world.

“Grateful for my wife, family, friends, and Pastors for dia love, prayers, and support. Thank God for my health and trust say dis latest victory na final in Jesus’ name di ogbonge singer add.

For 2017 Banky W bin reveal how e go through three successful surgeries to commot tumours from im shoulder.

Dat time too, na through one long social media post e bin share di news say e “treat one rare strain of skin cancer wey bin show face afta e first show 10 years ago”.

Wetin be skin cancer?

Skin cancer dey shele wen skin cells dey damaged, for example, by overexposure to ultraviolet (UV) radiation from di sun, according to Cancer Council for Australia.

Na three main types of skin cancer dey:

*basal cell carcinoma (BCC)

*squamous cell carcinoma (SCC)

*melanoma – dis na di most dangerous form of skin cancer.

Both basal cell carcinoma and squamous cell carcinoma dey popular as non-melanoma skin cancer or keratinocyte cancers. Keratinocyte cancer dey more common in men, e almost double dat of women.

E also get some kind rare types of skin cancer including Merkel cell carcinoma and angiosarcoma.

Diagnosis of skin cancer

E dey important to check your skin from time to time and check wit your doctor if you notice say any change dey.

Treatment for skin cancer

Skin cancers almost always dey removed. For some more advanced skin cancers, doctors fit remove some of di surrounding tissue to make sure say dem don comot all of di cancerous cells.

Di one wey common pass for treatment for skin cancer na surgery to remove di cancer - dat na under local anaesthetic.

Common skin cancers fit dey treated wit ointments or radiation therapy (radiotherapy).

Cryotherapy – to use liquid nitrogen to shaparly freeze di cancer off, curettage - to scrap or cautery – to burn, na methods wey sabi pipo fit also use to comot cancer.

Source: BBC