Menu

How Interpol arrest ova 200 cybercrime scammers across Africa

Screenshot 2025 09 26 161957.png Foto of security pipo wey dey stand

Fri, 26 Sep 2025 Source: BBC

Authorities across Africa don arrest hundreds of suspected cyber scammers for one coordinated international sting wey di UK fund.

Di operation wey dem call Operation Contender 3.0. - involve di assistance of Interpol.

Investigators say di cyber crime scammers dey responsible for estimated losses of nearly $2.8 million.

Di sting bin target criminal networks across Africa wey dey use digital platforms, like social media.

Di Investigator focus on romance scams - dis na wen criminals build relationships wit victims online to collect money from dem.

Dem also target di pipo wey dey do 'sextortion', wey involve blackmailing victims wit private images.

Dem arrest 260 pipo from di operation across 14 African kontris, wey include Ghana, Kenya and Angola.

Interpol say dem identify more dan 1,400 victims wey dey linked to di scams and di losses dey estimated at 2.8 million US dollars.

Research show say Africa don see sharp rise for cybercrime as di region dey undergo high growth for di digital technology sector.

Dis no be di first time wey Interpol dey collabo wit local authorities to do arrests like dis.

For March 2025, di International Police bin confam say dem arrest ova 300 suspects of cybercrime scam for dia operation wey scata criminal networks.

Di Interpol bin reveal say na for seven African kontris dem do di operation wia authorities gbab a total of 306 suspects.

According to Interpol, di operation target mobile banking investment and messaging app scams wia dem also discover more dan 1,500 victims.

"Di arrests na part of Operation Red Card, from November 2024 to February 2025, wey aim to stop and scatter cross-border criminal networks wey dey cause major harm to individuals and businesses"

"Authorities for seven African kontris don arrest 306 suspects and seize 1,842 devices for international operation wey dey target cyber attacks and cyber-enabled scams."

Di seven African kontris wey involve for di Operation Red Card na Benin, Côte d'Ivoire, Nigeria, Rwanda, South Africa, Togo and Zambia.

Dis kontris exchange criminal intelligence on key targets wia Interpol bin provide information on di mode of operations of criminal based on data from dia partners.

Nigeria dey lead wit di highest numbers of arrested suspects while Rwanda, South Africa and Zambia dey follow.

Recently di Federal Bureau of Investigation announce a reward of up to $10,000 for information wey go lead dem to arrest and convict one Nigerian citizen wey dem identify as Olumide Adebiyi Adediran, wey bin japa from authorities more dan 20 years ago.

FBI yarn dis one inside one statement for dia website on Wednesday 24 September wia dem say Adediran bin japa from di Central District of Illinois for late December 2001, just bifor im federal trial bin dey scheduled to begin.

E bin dey face multiple charges including bank fraud, identification document fraud, and credit card fraud.

Cases like dis plenti well-well as many pipo dey complain about scammers online wey dey defraud unsuspecting victims.

For December 2024, FBI extradite Nigerian on dia most wanted list from Ghana for 'yahoo-yahoo'

For April 2023, law enforcement authorities for di Republic of Ghana bin arrest Kayode according to one U.S. request for im extradition.

FBI explain say Ghanaian authorities grant request and surrender Kayode to FBI special agents wey bring am to di District of Nebraska.

Kayode bin get initial appearance on di Indictment on December 11, 2024. United States Magistrate Judge Michael D. Nelson bin order say make Kayode remain for detention pending trial.

According to di accuse, pipo wey Kayode and dem bin togeda dey run di business go pose as chief executive officer, president, owner, or oda executives of di targeted company to do dem wayo.

Source: BBC