Menu

How far Nigeria don reach to change Donald Trump ban bifor di 60 days deadline?

Screenshot 2025 07 01 122906.png President Bola Tinubu (L) and President Donald Trump

Tue, 1 Jul 2025 Source: BBC

Recently, President Donald Trump administration don announce say dem go soon enforce rules wey go block citizens from Nigeria, Ghana and 34 oda nations from entering di United States, even if dem get valid visa or to stay back afta di 60 days grace period afta di termination of appointment.

Dis new directive of travel wey dem dey currently dey refine dey set to become policy as e dey come from renewed executive order wey dem do to tighten American national security.

Kontris wey dey affected
Di list of possible kontris wey fit dey affected:

Nigeria, Ghana, Niger, Senegal, Republic of Benin, Burkina Faso, Cameroon, Ivory Coast, Egypt, Gabon, Tanzania, Gambia, Ethiopia, Malawi, Liberia, South Sudan, Angola, Antigua and Barbuda, Bhutan, Cambodia, Cape Verde, the Democratic Republic of Congo, Djibouti, Dominica, Kyrgyzstan, Mauritania, St. Kitts and Nevis, St. Lucia, São Tomé and Príncipe, Syria, Tonga, Tuvalu, Uganda, Vanuatu, Zambia and Zimbabwe.

Why di deadline and possible ban?

Di sweeping 60 days travel ban deadline dey come from renewed executive order wey dem do to tighten national security and as necessary crack down by say dem restrict migration from kontris wey dem flag say dem no get beta identity verification systems; visa overstays; potential national risks; or suspected links to terrorism.

Dem give di 60 day deadline to di goments of dis targeted kontris and e instruct dem make dem submit wetin dem call actionable remediation plans to address security and documentation wahala ova dia illegal immigrants wey dey live for America.

Dis also add to di grace period wey dem give non-immigrant workers wey dem don sack or wey by demsefs decide to resign from dia work for America.

Di grace period according to di USCIS wey dey in charge of immigration wahala for America na optional regulatory provision wey allow some eligible non-immigrant workers wey get dis visas: H-1B; E-1; E-2; E-3; L-1; H-1B1; 0-1 and TN to still stay for di United States while dem dey file to change to anoda non-immigrant visa.

How Nigeria goment dey handle di mata?

Nigeria Minister of Foreign Affairs and Chair of di ECOWAS Mediation and Security Council, Ambassador Yusuf Tuggar don tok say e dey worry ova how dis new wave of US visa restrictions fit affect African kontris and Nigeria in particular.

E say di ministry dey work hard on any of di commas wey dem find for screening, vetting or taking back of citizens as di cable tok.

Oga Alkassim Abdul Kadir wey be di special assistant on media and communication to di minister of foreign affairs also explain give di BBC say di diplomatic cable wey di US Department of State send bin tell embassies and consulates for dis kontris to judge dia host kontris by dia willingness to improve dia citizens travel documentation and take steps to address di status of dia nationals wey dey for America illegally. Di Nigerian goment don collabo wit di necessary bodies to address di mata.

How Ecowas react to di possibility say dem fit ban dem

Oga Tuggar wey tok on behalf of Ecowas kontris about di mata for di 54th Ordinary Session of di Ecowas Mediation and Security Council for Abuja, Nigeria; warn say if President Trump ban dem las-las e go block trade, diplomatic engagement and regional growth well-well.

E say, "e go dey unfortunate if e come to pass becos we be region of opportunities wey readi to do deals".

Oga Tuggar say di policy dey more like diplomatic misstep as e torchlight how e fit cast economic collabo for time wen West Africa dey positioned for global partnerships.

E note say "we get critical minerals and even rare earth like Samarium from di Monazite wey dem find for my home state of Bauchi".

E also add say, "we for dis part of di world na students for di Art of di Deal and we don dey part of di international trading system even bifor di modern state system".

Di foreign affairs minister follow appeal to di United States make dem rethink dis move say di region get oda options.

E say "Ecowas kontris and di US get rare opportunity to create partnership based on need. We also be beta option to more distant and politically different energy producers."

E add say, "we go do deals to prosper, di only question na wit who? Who go collect di opportunities for our region by allowing goment officials, and technocrats, business executives and business pipo to travel freely to go come back so dem go fit close deals."

Till now, world pipo still dey wait for di deadline to finish so dem go know which kontris President Trump administration go partially or completely ban as dem don plan am.

Source: BBC