BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

How gunmen carry out deadly attacks on synagogue and churches for Dagestan

Screenshot 2024 06 25 105253.png Gunmen shoot cars and buildings dey burn for Russia attacks

Mon, 24 Jun 2024 Source: BBC

Attacks on police posts, churches and one synagogue for Russia North Caucasus republic of Dagestan don kpai about 19 police officers and some civilians. Six gunmen also die.

Di attack wey show say e dey coordinated bin target di cities of Derbent and Makhachkala for di day of Orthodox festival of Pentecost.

Authorities neva sabi those wey get hand for di gbege, but Dagestan in di past na di scene for Islamist attacks.

Di republic head, Sergei Melikov, tok say e sabi who dey behind di attacks, but e no give details.

Two churches and one synagogue na di target for Sunday attacks, and one police post for Makhachkala, Dagestan largest city. One Orthodox Church priest dey among those wey dem kill.

Na Oga Melikov bin give di figure of more dan 15 police officers wey dem kpai . E also tok say some civilians bin lose dia life, including one priest, Father Nikolai Kotelnikov, wey e tok say don serve Derbent for more dan 40 years.

Oga Melikov bin announce say three days of mourning go begin on Monday.

Authorities neva name di gunmen, but for one video on Telegram, Oga Melikov tok say na for abroad dem prepare dia attack and say Dagestan now directly get hand for Russia war for Ukraine.

"We sabi who dey behind di organisation of di terrorist attacks and which goal dey bin pursue," e tok.

One ogbonge Russian nationalist for occupied Ukraine, Dmitry Rogozin, bin warn say if dem blame every attack on "di machinations of Ukraine and Nato, dis pink mist golead us to big gbege".

Video wey dem post for social media bin show pipo wey wear dark clothes dey shoot police cars, before convoy of emergency service vehicles land for di scene.

For Derbent - wey be home of one ancient Jewish community - gunmen bin attack one synagogue and one church, wey dem later set on fire.

Tori pipo tok say one police motor also dey attacked for di village of Sergokal. Police bin detain Magomed Omarov, head of di Sergokalinsky district near Makhachkala, afta tori say two of im sons dey among those wey carry out Sunday attacks.

Russian news agencies bin report on Monday morning say di counter-terrorism operation wey dem launch afta di attacks now don end.

Dagestan, one of di poorest parts of Russia, na mainly Muslim republic.

Between 2007 and 2017, one jihadist organisation, Caucasus Emirate, and later di Islamic Emirate of di Caucasus, bin stage attacks for Dagestan and neighbouring Russian republics of Chechnya, Ingushetia and Kabardino-Balkaria.

Afta one attack on di Crocus City Hall venue near Moscow for March, authorities bin point finger of blame for Ukraine and di West, even though di Islamic State group claim am.

Back den, President Vladimir Putin bin insist say "Russia no fit be target of terrorist attacks by Islamic fundamentalists” sake of say e “show one unique example of interfaith harmony and inter-religious and inter-ethnic unity”.

And yet, for three months wey don pass, Russia domestic security service, di FSB, bin report say dem prevent one IS plan to attack one Moscow synagogue.



Source: BBC