BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

How man allegedly sell im papa to ritualist for 1.8m naira

One magistrate court for Ado-Ekiti don remand three pipo for correctional facility

Tue, 28 Mar 2023 Source: BBC

One magistrate court for Ado-Ekiti don remand three pipo for correctional facility sake of alleged kidnapping and killing of one 82-year-old man, Michael Obasuyi.

Di magistrate, Bankole Oluwasanmi order say make di suspects dey remanded pending advice from di Director of Public Prosecution (DPP).

One of di suspects na di man son wey be 42-year-old Sunday Obasuyi, one 51-year-old Akinniyi and one 51-year-old Bobafe Sunday.

How e take happun?

Di prosecutor, Inspector Akinwale Oriyomi, tell di courts say Sunday and Bobafe kidnap di man on 1 February around 11am for Agbado-Ekiti, Gbonyin Local Goment Area.

Oriyomi tok say dem later discover di man deadi bodi for shallow grave some weeks later.

E say Sunday conspire wit Akinniyi and sell im papa to Sunday wey be herbalist for 1.8 million naira.

E tok say di offences contravene Sections 280, 279 and 234 of di Criminal Law of Ekiti State, 2021.

Kidnapping for ritual or ransom na issue

Kidnapping for ritual purpose or ransom na one of di issues wey Nigeria dey face and police and oda security agencies dey work day and night to rid di kontri of dis menace.

But as arrest and prosecution dey take place, dis one no stop jaguda pipo from engaging in dis illegality.

On 25 February 2022, nearly five years afta police arrest am, court find notorious kidnapper Chukwudimeme Ohamadike aka Evans guilty of criminal conspiracy and kidnapping.

Police arrest bin Evans for Lagos on 10 June 2017.

Im bin dey control kidnapping, armed robbery for southwest and southeast parts of Nigeria.

For 2022, police for Ogun State, southwest Nigeria bin arrest four young boys sake of alleged killing of di girlfriend of one of dem for money ritual.

For 2021, police for Enugu gbab one man wey allegedly bury im seven-year-old son alive sake of ritual purpose.

Police for di state for statement say dem confirm di case of missing pikin and allege say di 36-year-old papa na im kill am.

Mother of di pikin Madam Onyishi for di interview wey she do wit BBC Igbo say she bin no suspect say her husband fit use dia pikin do money ritual.

She say her husband na tricycle (keke) driver and dem get six pikin togeda and di pikin wey die na her second born.

Police tok-tok pesin Daniel Ndukwe say "investigation reveal say Chidi confess to di crime and lead Police Operatives to di arrest of one Pastor Okeke Eneokwor wey be 95 years old.

President Buhari assurance on ending insecurity

Nigeria President Buhari on different occasions don assure Nigerians of curbing security challenges for di kontri.

E say im administration dey committed to win di war against terrorism and oda forms of insecurity for di kontri.

Buhari on 3 March say im go ensure say before im komot from office, e go ensure say insecurity end for di kontri.

E commend di military efforts to ensure peace and stability for di kontri and promise say e go ensure say dia labour no go dey unrewarded.

“As a kontri, we dey proud since di first seven years we don revitalise our armed forces for di protection of di Nigeria territorial integrity wey Boko Haram insurgency and oda forms of criminality bin violate," Buhari tok.

Source: BBC