Menu

How social media help student wit disabilty to get medical doctorate

Screenshot 2025 03 03 181602.png Dr Beniam Esayas

Mon, 3 Mar 2025 Source: BBC

Dr Beniam Esayas don finally becom medical doctor but e take intervention from pipo on social media for am to reach wia dey go.

First of all, dem born Dr Esayas witout im lower left arm. But e no affect im love for school. In fact im score for Ethiopia Class 12 national examination high sotay e bin dey assigned to Tikur Ambessa school of medicine for Addis Ababa University.

E say, "I bin wan be doctor since I be small pikin. Wen I get beta grades for grade 12, my elders advise me say make I go medical school."

Afta e go school for four years and some months witout wahala, e say na so e come jam road block from im school.

According to Dr Esayas, dem start to dey hala am say make e either drop out or make e pick anoda department to continue im study.

"Wen dem bin dey pressure me to stop dis study, I tell dem make dem write letter to tell me dia reasons. Na so dem send letter say I no fit practice di profession like delivery and oda tins wit just one hand.

"Na so I carry di letter wey dem give me go di University higher management, dem kon write letter say make dem correct dia decision becos if dis be di case why dem no ban am at first and allow am reach dis level"

Even though high management chook mouth, im college still no allow am attend classes.

E say, "I try to solve di mata internally but e no work. Na wen I carry di mata go social media na im I find solution."

To deny am wetin e don dey work towards since childhood now wey e dey halfway to graduate, make am to dey veri depressed for months and na wetin make am decide say e go carry di mata enta social media.

Two years ago na wen Dr Esayas mata enta social media and go viral as mata of discrimination sake of physical disability.

As di mata continue to dey hot for social media, di college kon decide say e go fit continue to study di medicine wey im bin dey study.

"I bin dey inside difficult time. Na God help me. If my family and pipo no tanda gidigba by my side and fight for me, I for no dey here now," Dr Esayas tok.

Afta e study for di medical doctorate for seven years, Dr Esayas finally graduate from di college.

Dem name am as special awardee for di inauguration ceremony and even get special recognition from di Minister of Health.

E tell BBC say e sweet am say e fit graduate for profession wey im love and say pipo wey get disability, make dem no give up.

"To dey disabled no mean mental disability. So wetin pesin fit do one way, dem fit do am anoda way, so pesin wit disability no suppose dey humiliated wit wetin pesin tell am. Dem gatz dey confident."

Source: BBC