BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Hunters dig out baby wey pesin bury alive, thinking say na yam

Baby.png Dem find di baby wey dey unconscious

Thu, 16 May 2024 Source: BBC

Dis na one heart-breaking tori of survival wey involve new born baby wey pesin bury alive.

Na miracle dem take discover di baby wey hunters for one rural village of Anshav Kusuv rescue.

Anshav Kusuv na community for Tyowanye for Benue State, North Central Nigeria.

Hunters dig up di baby afta dia dogs begin bark to one unusual movement underground for one harvested yam farm.

Dem find di baby wey dey unconscious. Di discovery shock di farmers and many pipo for di community.

ASP Tooga Lorlumun of di Tyowanye Police Station tok say “di incident neva dey officially filed but don spread through local tok-tok for di market square”.

Oga Tooga tell BBC News Pidgin say as di dog sniff di location, di farmers begin dig, thinking say na yam dem wan dig out.

"Na until dem discover say no be yam dem dey dig make dem come dey carefull bifor dem see say na human beign," di police officer tok.

Anshav Kusuv, dey within di Buruku local goment area.

Na one community of farmers and hunters wey evri body sabi dia sef. Di community no too get plenti amenities and healthcare facilities. Di pipo struggle.

Di baby wey neva get name dey recieve treatment for one maternity clinic for di village. She dey battle for survival from complication of her wicked burial.

One of di caregivers, madam Emmanuel Numbur complain over di terrible state of di clinic. She say e dey difficult to give di baby di kain medical attention wey she need now.

Numbur also tok about how difficult e dey for her to look after di baby sake of di situation of her pocket.

"Di baby condition dey bad," Numbur tok as she highlight di urgent need for better medical attention.

Despite di brave efforts of di clinic staff, di pikin condition no dey clear.

Sake of dis, quick need for improved healthcare infrastructure for rural areas like Anshav Kusuv dey necessary.

As di community dey rally around di fragile life of dis miracle baby, plenti kwesion dey rise about di circumstances wey lead to how dem bury her for ground.

And anoda kwesion about challenges wey dey face healthcare for rural Nigeria.

Tori from Benue state no dey strange for news as di state dey battle gbege of insecurity sake of farmer-herders crisis and ethnic clashes.

But tori of baby wey dem bury alive na one strange tin wey many pipo tok say suppose dey investigated wella.

Source: BBC