Tuface Idibia bi Legendary musician for Nigeria
Legendary musician Tuface Idibia don assure im fans say im dey okay and add say make dem calm down.
Di musician make di assurance for one video on social media to address di mata of im marriage wit im wife Natasha Osawaru Irobosa.
E say na dangerous situation and e sabi wetin fans fit do and wetin dey happun dey put im wife Natasha at risk.
"I need evribodi to calm down. Make evribodi ceasefire. We go resolve all dis issues. Pipo dey get issue for house, no be today," e tok.
Di call for ceasefire dey come less dn 24 hours afta di Edo State House of Assembly bin summon im wife Hon Natasha to appear bifor di House Committee on Ethics and Privilege.
Hon Natasha, wey dey represent Egor Constituency for di Edo State House of Assembly, chop accuse say she dey drag di House into rofor-rofor.
For plenary on Tuesday 2 December, Speaker Blessing Agbebaku say Honourable Natasha don dey trend negatively on social media.
Wetin don happun bifor now?
Tuface Idibia and im wife become major topic of discussion across social media platforms.
Di couple begin trend afta one gbas-gbos between dem during Instagram Live session wey media personality Daddy Freeze bin host. Di moment bin go viral around di same time one old video emerge online, wey claim say di singer chop arrest for di United Kingdom afta agbas-gbos wit Honourable Natasha.
During di Daddy Freeze live broadcast, wey bin feature several guests including some of Tuface former associates, di singer join briefly. Afta e appear, gbas-gbos between am and Natasha start on camera, and e lead to im sudden exit. Daddy Freeze share di clip on im Facebook page on Monday 1 November.
Around di same time, di alleged arrest video emerge on social media, wey show officers dey speak wit 2Baba outside wetin be like retail store.
Wen BBC News Pidgin reach out to Met Police to confam di arrest, dem say dem no dey respond to queries about pipo wey dem neva charge.