BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

'I want my seven-year-old pikin to fit waka and go school like her mates'

Screenshot 2024 06 18 160354.png Since 2017 wey Suebat mama born am, she don dey hope say one day her pikin go fit tok and waka

Mon, 17 Jun 2024 Source: BBC

Since 2017 wey Suebat mama born am, she don dey hope say one day her pikin go fit tok and waka and go to school like her mates.

Seven-year-old, Suebat case fit be infection or genetic condition, based on medical expert opinion.

For Suebat parents, Taiye and Abdulganiu Zakariyau, di experience dey difficult for dem as none of dia oda children get dis condition but dem dey determined to find solution so dia pikin go fit join her mates for school and Arabic classes.

"My seven-year-old daughter dey small, she no fit talk, she no fit walk. Her mates dey attend school and Arabic lesson.

"I no dey happy wit her condition, she no fit go to school or Arabic classes. She just no fit do anytin for herself, she dey sidon for one place. She dey poo and pee for dat position," Suebat mama tok.

Suebat wey be di fourth child get older and younger siblings, and her mama want make she dey join dem go school make she no dey just stay for house wit her grandmother wey be her primary caregiver.

Suebat mama tok say her mama bin face different discrimination for dia former house becos of Suebat condition and pipo bin dey abuse am verbally, emotionally and physically.

"She dey always stay wit her grandmother. Wia grandma bin dey live, dem tell am say dem no fit allow such baby for dia house. Make she comot for di apartment or return di pikin to her mother," she tok.

Also, Suebat papa tok say im do dey see all dis discrimination becos im pikin na "fine girl" wey no dey "irritate am".

'Malnutrition or genetics fit cause stunt growth' -expert tok

Yusuf Mohammed, wey be paediatric doctor for di University of Ilorin Teaching Hospital, tok say stunt growth in children fit be as a result of malnutrition, infection or genetics

Doctor Mohammed wey be di head of paediatric department of di hospital tell BBC News Pidgin say di genetic cause dey difficult to control becos you no fit change di gene wey dey inside di pikin bodi.

"But e depend on di inheritance, some parents dey carry di gene. If two parents wey be abnormal gene carriers come togeda e fit cause am.

Di doctor advise say, e go betta make couple go for medical examination and counselling bifor dem begin born pikin so expert go fit tell dem wetin dem go do medically.

"Wetin dey cause am vary becos bodi dey different, sometimes if problem dey wit di protein wey dey inside di bodi, e fit cause am."

E say feeding or infection fit also cause am.

Doctor Mohammed also tok say recommendation for treatment or prevention go be based on di external factors wey cause di delay in growth.

Di paediatrician explain say some pikin wey dey experience growth delay sake of say dia mama no go for antenatal care and di pikin develop atresia.

E say e fit also be becos of infection or environmental toxicity wey di pikin dey exposed to afta dem born am.

"Pikin wey dem born wit atresia no fit feed properly, so di pikin go lack di nutrition e need to grow," Doctor Mohammed tok.

Expert chook mouth on Suebat mata

Yusuf Mohammed, wey be paediatric doctor for di University of Ilorin Teaching Hospital, tok say failure to thrive in children fit be as a result of malnutrition, infection or genetics

Doctor Mohammed wey be di head of paediatric department of di hospital tell BBC News Pidgin say di genetic cause dey difficult to control becos you no fit change di gene wey dey inside di pikin bodi.

"But e depend on di inheritance, some parents dey carry di gene. If two parents wey be abnormal gene carriers come togeda e fit cause am.

Di doctor advise say, e go beta make couple go for medical examination and counselling bifor dem begin born pikin so expert go fit tell dem wetin dem go do medically.

"Wetin dey cause am vary becos bodi dey different, sometimes if problem dey wit di protein wey dey inside di bodi, e fit cause am."

E say feeding or infection fit also cause am.

Doctor Mohammed also tok say recommendation for treatment or prevention go be based on di external factors wey cause di delay in growth.

Di paediatrician explain say some pikin wey dey experience growth delay sake of say dia mama no go for antenatal care and di pikin develop atresia.

E say e fit also be becos of infection or environmental toxicity wey di pikin dey exposed to afta dem born am.

"Pikin wey dem born wit atresia no fit feed properly, so di pikin go lack di nutrition e need to grow," Doctor Mohammed tok

Source: BBC