BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Indian bride run afta she fire gun for her wedding

Celebratory firings during weddings most times don lead to accidental deaths

Mon, 10 Apr 2023 Source: BBC

Police for di northern Indian state of Uttar Pradesh dey look for one woman wey fire gun for her wedding.

One video on top social media show as di woman fire four rounds of bullets into di air as she sidon next to her husband.

Local police say dem don register case against di woman, wey dey miss since di incident.

Celebratory gunfire during weddings dey common for some northern Indian states and e dey most times cause injuries and even accidental deaths.

According to Indian law, anyone wey use firearm "for rash or negligent manner or for celebratory gunfire", wey put odas for danger, fit go prison or pay fine or both.

For 2016, one court for Uttar Pradesh capital, Lucknow, bin order say make dem investigate every case of celebratory gun fire regardless of weda dem bin file police complaint or not.

According to tori pipo di Times of India newspaper, one relative of di bride record di video and post am on social media.

Police tell di paper say di woman don "run" because she dey fear arrest.

Last week, one viral video from di western state of Maharashtra bin show how sparkle gun backfire for one bride face as she and her husband bin dey pose wit am for dia wedding photos.

Source: BBC