Israeli strikes on Nasser Hospital for Gaza on Monday kill at least 15 pipo
Israeli strikes on Nasser Hospital for Gaza on Monday kill at least 15 pipo, including three journalists, one of dem bin dey work for Reuters, Palestinian health officials said.
Reuters report say cameraman Hussam al-Masri, one of di journalists wey die for di strikes according to di officials, na contractor for dem. Photographer Hatem Khaled, wey also be Reuters contractor, injure, di officials said.
Di Israeli military and Prime Minister's Office no get immediate comment regarding di strikes.
You go remember say Israel defence minister bin don warn say dem go destroy Gaza City if Hamas no agree to disarm and release all hostages.
Israel Katz comments dey come afta di Israeli cabinet approve plans for a massive assault on Gaza City, despite widespread international and domestic opposition.
At least 15 pipo wey include four journalists wey dey work for di international media dey among dem wey dem kill for di Israeli strike on hospital for di southern Gaza Strip.
Reuters cameraman and Associated Press journalist dey among dose wey dem kill for di attack for Nasser Hospital.
Dem kill several pipo for di first strike, and odas for di second wey happun as rescuers attend di scene, di Hamas-run Civil Defence tok.
Di Israeli military and di prime minister office say di dem no get any immediate comment.
Meanwhile, di death toll still dey increase.
On Monday 18 August, Hamas bin agree to one proposal by Qatari and Egyptian mediators for 60-day ceasefire, wey according to Qatar go see di release of half of di remaining hostages for Gaza.
But Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu apparently reject dis, say e bin don give instruction for negotiations to begin for di release of all remaining hostages and an end to di war in Gaza on terms wey dey "acceptable to Israel".
Monday attack dey come two weeks afta six journalists wey include four from Al Jazeera, die for Israeli targeted attack near al-Shifa Hospital for Gaza City.
Di UN human rights office condemn di attack wia dem call am grave breach of international law.
Di Israel Defense Forces (IDF) say dem target Anas al-Sharif, popular Al Jazeera reporter, wey dem allege say e "serve as di head of terrorist cell for Hamas".
Di Committee to Protect Journalists (CPJ), leading body wey dey promote press freedom, say Israel don fail to provide evidence to back up dia allegations.