Menu

Israeli strikes kill 17 Palestinians for Gaza, order hospital to evacuate

Israeli Gaza Jet Strikes A file photo to represent the story

Sun, 22 Dec 2024 Source: BBC

Israeli military strikes across Gaza Strip don kill at least 17 Palestinians, eight of dem for inside one school wey dey shelter displaced families for Gaza City, Reuters report.

Dis na as dem also order di evacuation of one hospital for di north, medics tok.

Palestinian medics tok say eight pipo wey include children, die for di Musa Bin Nusayr School wey dey shelter displaced families for Gaza City.

Israeli military for statement tok say di strike bin target Hamas militants wey dey operate from one command centre inside di school.

Dem say Hamas militants bin use di place to plan and execute attacks against Israeli forces.

Also for Gaza City, medics say four Palestinians die wen airstrike hit one car.

At least five oda Palestinians die for inside two separate airstrikes for Rafah and Khan Younis south of di enclave.

For di northern Gaza town of Beit Lahiya, wia di army don dey operate since October, Hussam Abu Safiya, di director of Kamal Adwan Hospital, tok say di army order staff to vacate di hospital and move patients and injured pipo go anoda hospital for di area.

Abu Safiya say di mission bin dey "next to impossible" bicos staff no get ambulances to move di patients.

Di Israeli army don operate for di two towns of north Gaza, Beit Lahiya and Beit Hanoun, also for di nearby Jabalia camp for nearly three months.

Palestinians don accuse Israel say dem dey carry out acts of "ethnic cleansing" to depopulate those areas to create barrier zone.

Israel don deny accuse and say di campaign for di area na to fight Hamas militants and stop dem from regrouping.

Dem say dia forces don kill hundreds of militants and dismantle military infrastructure since dat operation start.

Armed wings of Hamas and di Islamic Jihad say dem don kill many Israeli sojas in ambushes during di same period.

Mediators neva secure a ceasefire between Israel and di Islamist group Hamas.

Sources close to di discussions tell Reuters on Thursday say Qatar and Egypt don dey able to resolve some differences between di warring parties but sticking points remain.

Israel stand dia assault on Gaza afta Hamas-led fighters attack Israeli communities on Oct. 7, 2023, killing 1,200 pipo and take ova 250 hostages, according to Israeli tallies.

Israel say Hamas still hold about 100 hostages, but e no dey clear how many still dey alive.

Authorities for Gaza say Israel campaign don kill more dan 45,000 Palestinians and displace most of di population of 2.3 million.

Source: BBC