BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Jada Pinkett drop bombshell about her and Will Smith marriage in di last seven years

Jada and Will Smith

Wed, 11 Oct 2023 Source: BBC

American actress Jada Pinkett Smith don reveal say her and popular American actor Will Smith dey live separate lives since 2016.

Di 52-year-old actress tok for one interview with tori pipo Today, say dem don secretly separate for about seven years.

Di presenter, Hoda ask “so from di year 2016, wey be seven years ago una two don dey apart?” “Yes” Jada Smith tok.

She reveal say dem dey legally married as couple but na ontop paper as dem no dey romantically togeda again “we dey live seperately.”

Jada Pinkett explain say she bin separate from her husband becos both of dem tire from trying but dem bin dey try to stay married becos of di fantasy of wetin individuals suppose dey do as married couple.

"Why we break up, na a lot of tins," di actress tok. "I tink by di time, we reach 2016, we don dey exhausted wit trying," Jada tok.

Wen di reporter ask her why dem bin no mkae di information about dia separation public, she say: "I bin tink say we neva ready, we dey try figure out between di two of us how we go fit dey in partnership and how we go show am to pipo."

Jada Pinkett explain say di koko of di mata be say she no dey ever consider divorce for dia marriage becos she bin don promise say reason no go dey for dem to "divorce" and she no wan break dat promise.

Source: BBC