Menu

Jamie Foxx reveal di sickness wey do am for 2023

345cca60 B714 11ef Bae3 75ea1048aab7 Hollywood star Jamie Foxx

Wed, 11 Dec 2024 Source: BBC

Hollywood star Jamie Foxx don reveal wetin cause im hospital admission for April last year.

For tok during one Netflix special, di Django Unchained star tell di audience say e bin suffer "brain bleed wey bin lead to stroke".

E tok say e bin get one bad headache one day and den ask for aspirin but bifor e go fit take am, e bin "pass out (black out). I no remember 20 days".

Dat time, im daughter Corinne Foxx bin tok say e bin experience "medical complication" but di family no share details about im health issues.

For one emotional chat wit di audience for Jamie Foxx: What Had Happened Was..., wey dem record for Atlanta, di city where e bin dey work wen e fall ill, Foxx say medics bin first send am home afta dem give am cortisone injection.

Im sister den come over to see am and feel say e no be imself so she take am inside her car to Piedmont Hospital.

Na den wey doctor tell am say e get brain bleed wey don lead to stroke, add say: "If I no go inside im head right now, we go lose am."

E tok say im sister bin pray di whole time during im operation outside di theatre.

Doctors bin no fit locate di origin of di brain bleed.

Foxx bin also tell di audience say "your life no dey flash bifor your face, e bin dey kind of peaceful, I bin see one tunnel, I bin no see di light."

E bin joke: "E bin dey hot for dat tunnel, I dey go di wrong place?"

Foxx tok say di doctor bin tell im family: "E fit dey able to make full recovery but e go be di worst year of im life."

Di star bin heap praise on im sister Deidra Dixon and daughter Corinne sake of dem "hold am down" so no-one go see am.

"Dey no want make you see me like dis and I no want make you see me like dis," e bin tell im fans.

E bin signal say im head movements dey little unsteady afta di stroke and im daughter dey worry say pipo go make memes out of am.

E tok say e bin wake up on 4 May 2023 and dey inside one wheelchair sake of say e no dey able to waka, and no remember why, e add say e bin first dey denial: "Jamie Foxx no dey get stroke."

E reveal say e later undergo rehabilitation for Chicago.

Foxx bin dey film Netflix Back In Action alongside Cameron Diaz wen e become sick.

Since den, e don tok well of di support wey e bin receive from im family but dis na di first time wey e give detail about im condition.

Wetin be di signs of stroke?

Stroke dey happun wen blood stop to dey flow to one part of your brain.

Di first signs include:

a. Face weakness –e fit dey hard to smile, and one side of your face fit fall.

b. Arm weakness – you fit no dey able to fully lift both arms and keep dem there sake of weakness or numbness in one arm.

c. Speech problems – you fit dey drag your words or sound confused.

Oda symptoms fit be:

. Sudden weakness or numbness on one side of your body. (including in your leg).

. Sudden loss of vision or blurred vision in one or both eyes.

. Sudden difficulty speaking or thinking of words.

. Sudden memory loss or confusion.

. Sudden severe headache.

. Sudden dizziness, unsteadiness or sudden fall, especially wit any of di oda signs.

Source: NHS.uk

Source: BBC