BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

John Cena don announce retirement from wrestling

Screenshot 2024 07 08 110818.png American actor and wrestler John Cena

Sun, 7 Jul 2024 Source: BBC

American actor and wrestler John Cena don announce say e dey retire from competing for di World Wrestling Entertainment (WWE) events.

Cena make di surprise announcement to fans wen e show for di WWE Money in di Bank event for Canada.

Di 47 year old wey start to dey act 18 years ago, say im final in ring competition go happun for 2025 as part of im farewell tour.

Cena wey pipo sabi as one of di greatest professional wrestlers of all time and don win world champion 16 times since e join di WWE for 2001.

E tell fans for Toronto say, "Today finally announce my retirement from di WWE".

Im shocked fans manage later hala "thank you Cena."

E make dis announcement as im wear shirt wey tok say, "Di Last Time Is Now" and im trade mark "jorts", e thank WWE fans say dem "let me play for di house wey una build for many years."

For press conference wey im do later, e reveal say im go like remain for di WWE family in some way, even though im feel like say e dey "at my end" physically.

John Cena start to dey act for 2006 wen e act for The Marine bifor im land big budget feem roles for feems wey include, The Suicide Squad, Fast & Furious 9 and Teenage Mutant Ninja Turtles.

Di star don stil dey run part time doings wit di WWE even afta im career blow for 2018.

E go viral dis year afta e wear nothing but envelope for Academy Awards skit dis year.

Di celebrity na also who pikin dey ask for pass for all time from di charity Make-A-Wish.

E get Guiness World Record for di number of wishes wey im don grant to Make -A-Wish pikin dem wey get critical sickness.

How John Cena waka for di WWE

Cena bin start im main rooster debut for June 2002. Na wen im accept di Kurt Angle challege wey im give come beat am join. as anonymous wrestler.

Apart from being di WWE world champion 16 times, di most of all time wey im dey share wit Ric Flair, e also be four time champion of di WWE tag team.

And e go win dis titles dem wit four different wrestlers: Shawn Michaels, Batista, The Miz and David Otunga

E also be one of di six men wey go win more than one Royal Rumble match.

E fight for im last WrestleMania events for 2012 and 2013 and di two times, e fight against anoda wrestler turn actor, The Rock.

Di last time Cena don get wrestling match na for November wen im lose to Solo Sikoa.

John Cena go still compete for di Royal Rumble, Elimination Chamber and WrestleMania 41 say im goal na to wrestle till di end of 2025.

Dem dey call im last group of matches as "The Last Time is Now John Cena Farewell Tour," wey dey come from im very popular theme song.

Source: BBC