Menu

Kamala Harris NBC interview in four short points

Kamala Harris Kamala Harris  Kamala Harris  Kamala Harris  GUxMv0xWgAAWOsw Vice-President Kamala Harris

Wed, 23 Oct 2024 Source: BBC

Vice-President Kamala Harris and her team dey prepared if her opponent, Donald Trump, declare victory for di presidential election before dem count all ballots, na so she tell NBC News.

Dem film di interview between Harris and Hallie Jackson for di US Naval Observatory and dem show am on Tuesday evening.

Di Democratic US presidential nominee answer questions about President Joe Biden poor debate performance before dropping out of di race, whether she go pardon former president Trump and di historic significance of her candidacy as a woman.

Dis na some of di key moments:

Hot exchange over Biden poor debate

Ms Jackson ask Harris if she bin dey honest about Biden wen she endorse im re-election bid.

"You no ever see anything like wey happen for di debate night behind closed doors with am?" Ms Jackson aske.

"Na bad debate. Pipo dey get bad debates," Harris reply, referring to di face-off between Trump and Biden for June.

Ms Jackson come follow up, saying Biden poor debate performance na di reason Harris now be di Democratic party nominee.

"Well, you go need to ask am if dat na di only reason why (e stand down)," Harris tok.

Ms Jackson again ask about Biden.

"I dey run for president of di United States. NotJoe Biden - and my presidency go dey bout bringing a new generation of leadership to America," Harris tok.

She come vouch for di president political achievements and leadership.

"I speak not only with sincerity, but with a real, first-hand account of watching am do dis work. I no get any reluctance to say so," she tok.

Harris plan if Trump prematurely declare imself di winner

Ms Jackson ask Harris wetin she go do if her Republican opponent declare imself di winner for di presidential race before dem count all di votes.

"We go deal with election night and di days after as dem come, and we get di resources and di expertise and di focus on dat as well," Harris tok.

In the hours after election day for 2020, Trump falsely declare imself di winner for di race against Biden, while dem still dey count di votes. Dem no decide di election until days later.

E dey currently face allegations say e pressure officials to reverse di 2020 results and knowingly spread lies about election fraud.

When di presenter ask if di Harris team go consider a similar thing on election day next month, di vice-president respond say "of course".

"Dis na person, Donald Trump, wey try to undo a free and fair election, wey still dey deny di will of di pipo, wey incite a violent mob to attack di United States Capitol... dis na serious matter," she tok.

Harris go pardon Trump?

Ms Jackson ask Harris if she go pardon Trump if she become president.

"I no go talk about hypotheticals. I dey focused on di next 14 days," she answer.

Wen dem ask her if pardoning di former president go help unify di country, she say:

"Make I tell you wetin go help us move on - I go dey elected president of di United States.''

On di country being ready for a woman president

Dem also ask Harris also whether US don ready for a woman of colour to be dia next president.

"Absolutely," she tok, without hesitation. "...I think part of wetin dey important for dis election no be only to turn di page, but closing di page and di chapter on a period wey suggest say Americans dey divided."

Ms Jackson come press Harris on why she dey drag leg to talk about di historic nature of her candidacy on di campaign trail. Harris go be di first female president if elected.

"I clearly be woman.... di point wey most pipo really care about na, you fit do di job and you get a plan to actually focus on dem," she tok.

When dem ask her if she dey concerned about sexism, Harris say she no view her candidacy dat way. Instead, she say her challenge on di campaign trail na making sure say she fit talk and listen to as many voters as possible.

"I no go ever assume say anyone for our country suppose elect a leader based on dia gender or dia race, instead di leader need to earn di vote based on substance and wetin dem go do to address challenges," she tok.

Harris later go on to discuss her agenda focusing on reproductive rights and abortion access.

Source: BBC