BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Kenya police fire teargas give anti-tax protesters as lawmakers dey chook eye for bill

Screenshot 2024 06 25 123741.png Kenyan police don fire tear gas and rubber bullets to scata protesters

Tue, 25 Jun 2024 Source: BBC

Kenyan police don fire tear gas and rubber bullets to scata protesters for di capital, Nairobi, as di anti-tax demonstrations across di kontri continue.

Businesses shut down and transportation don dey paralysed for di city, with police wey dey face di demonstrators.

Di protests wey di youths dey lead dey call on MPs to reject proposed tax increases.

Government, wey don row back on some of di most controversial measures, say new taxes dey needed to fund spending programmes and lessen di debt burden.

Crowds don also gada for many oda parts ofdi kontri, with local Kenya newspaper the Daily Nation reporting protests in about 30 of di kontri 47 counties.

Lawyers and human rights groups bin don expressed concern about anyhow arrests and di intimidation of activists during earlier protests.

E come as reports say at least five prominent social media users don dey abducted early mor-mor, hours before di demonstrations.

Government don defend di taxes as necessary for raising additional revenue to reduce Kenya significant debt, but last week dem accept some demands.

Dem scrap some controversial taxes including proposed taxes on bread, cooking oil and motor vehicle ownership as pipo protest.

But di protesters say e no dey enough, and dey call for di complete withdrawal of di bill.

Despite dat, majority MPs pass di controversial bill during im second reading and on Tuesday dem dey debate di various amendments, to remove some of di clauses wey di government see say get issues.







More fotos from di protest on Tuesday

Source: BBC