Di lady bin die for night of Saturday 20 December 2025
Kenyans don begin mourn di death of one young lady wey allegedly kpai during concert wey Nigerian music star Asake bin come perform.
Di lady bin die for night of Saturday 20 December 2025 afta crush bin happun for Nyayo Stadium during di concert.
Nyayo National Stadium get 18,000 capacity and na multipurpose stadium wey dey Nairobi, Kenya capital. Di stadium dey popular sake of di different national and social events wey dey happun for dia.
Also, anoda music artiste wey also dey di concert na Gabzy, a British-Nigerian singer wey base for London.
According to videos and fotos wey don dey trend for social media, di gbege bin happun wen wahala start for one side of di stadium and e make pipo begin dey rush.
Na from di rush di stampede bin happun and lead to di death of di young Kenyan lady.
Di death of dis young lady wey dem later identify as Karen Lojore don cause serious tok tok among Kenyans and oda music lovers wey attend di concert.
Although, full details ontop how di stampede happun, how many pipo dey affected and wetin really cause di whole, neva come out.
"During a musical concert for Nyayo National Stadium, brief stampede happun for di entry gate. While di situation later calm down and fans dey able to access di stadium."
"An unfortunate case of a 20-year old woman wey dem press to death near di entry point dey recorded," Kenyan police tok-tok pesin Michael Muchiri tok.
Wetin cause crush for di concert
On 20 December 2025, music lovers gada for Nyayo stadium for Nairobi, Kenya wia dem bin wan attend concert wia popular music artiste, Asake and oda musical artistes dey perform.
Report say plenti pipo wey get ticket and di one wey no get ticket bin wan enta di stadium despite di heavy securiti wey dey.
Account from pipo wey attend di concert say di gbege begin happun wen some fans wey no get ticket wan gain entrance into di concert venue.
Dem come begin dey push into di venue so dem go fit enta but di securit no gree.
Shortly afta, according to pipo wey witness am and post dia experience for social media, dem say di crowd bin overpower di securiti.
Na from di push and rush to enta di entrance bin cause di stampede, according to eyewitness report.
From di stampede di tori of di death of Karen Lojore begin dey trend.
Report say Karen get ticket to enta di venue but di gbege wey dey happun for di entrance lead to her death.
One similar suspected crush happun during one concert for di Brixton O2 Academy for south London for 2022, wen eight pipo land for hospital, wit four for critical condition.
Dat incident too, officers bin respond to reports of one big number of pipo wey dey try force dia way inside di venue.
Video for social media show one big crowd wey don gather outside di venue, wit one person claiming on Twitter say more dan 1,000 pipo don turn up without tickets.
For di video footage, di crowd bin dey stretch from di road outside to di venue doors, wit pipo screaming, shouting and struggling.
Wetin to know about Asake
Asake, wey im real name be Ahmed Ololade, dey nominated for BBC Radio 1 Sound of 2023 award.
E dey described for di venue website as "one of di hottest breakout stars from Nigeria" and dey tour im debut album, Oga Money Wit di Vibe.
Born and raised for Lagos State, im songs be part of di Nigerian street-pop subgenre wey blend Afrobeats wit Amapiano, pop melodies and street-smart rap lyrics.
E bin get one break-out hit for 2020 wit im single Lady.
Asake don get different era of how e don look from im hairstyle since im bin blow up for 2020 afta di release of im hit single Mr Money.
E don go from fat dreads to longer braids and even do tinted hair at some point in im career.
So far, Asake don run three albums wit YBNL for im career, wey dem call Mr Money With The Vibe, Work of Art and Lungu Boy.
Im first album Mr Money With The Vibe bin break record for di Billboard 200 chart as di highest charting Nigerian debut album wey di chart don get at dat time.
For 2023, e win di Next rated award for di Headies in September.
Asake describe how im join di label for different interviews say, "na Yhemoleee show Olamide wetin I fit do na so Olamide call me one day say make we see and wen we finally meet, wit out any paparazzi, e ask me weda I wan join YBNL, sometin wey I don dey wait for years".
For 2022, e sell out O2 Arena for concerts wey last three days sotay two pipo lose dia life for December on to stampede to try enta im show.
So far e don get two nominations for di Grammy awards. For 2024, e bin dey nominated for Best African Music Performance for im song Amapiano.
E also dey nominated for di 2025 Grammys of di same category for di song MMS wey im do wit fellow musician, Wizkid.