Menu

Key points from US lawmakers investigation on claims of religious genocide for Nigeria

Screenshot 2025 12 03 123244.png Photo of US and Nigerian flags

Wed, 3 Dec 2025 Source: BBC

Di US lawmakers don begin chook mouth into di violence and alleged claim say Christian genocide dey happun for Nigeria.

US President Donald Trump don give directive to di House appropriations committee for October say make dem investigate di mata of Christians for Nigeria. Trump say make dem report back wit dia findings.

Dis dey come afta US President Trump bin threaten to invade Nigeria afta e bin refer to Nigeria as 'disgraced kontri' and di USA go move to 'wipe out' terrorists.

For di lawmakers briefing, dem say e get rising violence and targeted persecution of Christians for Nigeria and dem no go ignore dat kain crisis.

Although bifor di lawmakers meeting, some high level delegation from Nigeria bin visit di US to see how dem go fit end di insecurity mata wey dey shake Nigeria.

For di visit, di Nigerian delegation reject any allegation for genocide for Nigeria.

"For all engagements for Washington, DC, di Nigerian delegation reject allegations of genocide for Nigeria, say violent attacks affect families and communities across religious and ethnic lines," di Nigerian authority tok.

Also, Nigeria President Bola Tinubu don approve constitution of di Nigerian side wey go dey di US-Nigeria joint working group.

Di group na to collabo to tackle di security challenges wey Nigeria dey face. Although di US neva release dia own list of who dey di joint-working group.

'Dis na targeted campaign'

According to Brian Mast wey be US House Foreign Affairs Committee Chairman, e say di attack wey dey go on for Nigeria na targeted campaign. Mast say no be just communal violence dey happun.

"Dis no be merely 'inter-communal violence' or a 'resource conflict,' as many claim. Dis na targeted campaign of religious cleansing."

Mast say 'weda na Boko Haram, Islamic State West Africa Province, or radicalized nomadic Fulani militants', dia objective na to drive Christians out of dia lands.

Di lawmaker say e dey stand wit President Trump for im decision to redesignate Nigeria as Country of Particular Concern.

"We must demand say di Nigerian goment disarm dis militias, return displaced families to dia homes, and bring di perpetrators to justice."

'Di world no go turn blind eye'

US lawmaker Riley Moore wey dey lead religious liberty advocate, e say Christians dey face crisis just becos say dem dey practice dia faith.

"Our brothers and sisters in Christ dey persecuted and slaughtered in Nigeria simply for professing dia faith in our Lord and Savior Jesus Christ."

Moore also add say na sake of di crisis make President Trump ask am to look into di 'horrific persecution of Christians for Nigeria.'

"Di world no go turn a blind eye to di persecution of Christians for Nigeria."

'All killings gatz stop'

For Honorable Vicky Hartzler, wey be di US Commission on International Religious Freedom Chairman, e say all di killings wey dey sup for Nigeria gatz stop.

According to Hartzler, e say religious freedom dey under serious wahala and e dey get worse.

"Just a few days ago, on November 22ⁿᵈ, dem abduct 303 children and 12 teachers for St. Mary's School, a Catholic institution for Niger State.

"No matter di group wey dey do dis violence, we must dey clear: religious freedom violations dey rampant.

Di US lawmaker also mention di Kwara state case wia jaguda pipo bin attack worshippers. E mention say no be say Muslims too no dey part of dose wey dey kpai but na di Christians plenti pass.

"E dey horrible, violent, and Christians na di predominant victims. But no matter di religion of di victim, all killings must stop, and di goment gatz take decisive action now to prevent any further killings."

Recommendations wey di US lawmakers make

Di US lawmakers bin issue some recommendations wey go help dem deliva dia work.

Honourable Hartzler highlight some recommendations:

.Di US goment gatz work directly wit di goment of Nigeria to improve dia accountability and transparency and help for areas of police training and reform, and conflict mediation.

.Di US goment must insist say Nigerian goment officials gatz respond wen e get early warning, to make sure say resources dey invested in using early warning systems to reduce community violence.

Di US goment gatz kontinue to work wit di Nigerian goment to provide technical expertise and oda forms of assistance to train, support, and counter violent insurgent groups so di entire region fit prosper.

Rep. Mario Díaz-Balart (R-FL), House Appropriations Committee Vice Chair and National Security, Department of State, and Related Programs Subcommittee Chairman,

Participants for di investigation

Rep. Robert Aderholt (R-AL), Labor, Health and Human Services, Education, and Related Agencies Subcommittee Chairman and Values Action Team (VAT) Chair

Rep. Riley Moore (R-WV), House Appropriations Legislative Branch Subcommittee Vice Chair and leading religious liberty advocate

Rep. Brian Mast (R-FL), House Foreign Affairs Committee Chairman

Rep. Chris Smith (R-NJ), House Foreign Affairs Africa Subcommittee Chairman

Honorable Vicky Hartzler, U.S. Commission on International Religious Freedom Chair

Sean Nelson, Alliance Defending Freedom International

Dr. Ebenezer Obadare, Council on Foreign Relations

Source: BBC