BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Kylian Mbappe signing for Real Madrid mark di return of di galacticos?

Screenshot 2024 06 04 140910.png Wit Mbappe, real madrid now dey boast of one of di deadliest attacks for world football

Tue, 4 Jun 2024 Source: BBC

Real Madrid once upon a time don assemble team wey everibodi for di football world sabi say na ogbonge team from goalkeeper to striker.

Dis na di era between 1998 - 2002 wey football pipo dey call di galacticos.

For di history of di Spanish club, dem go 32 years without European trophy until dat era wen di galacticos don begin to click.

Between di late 1990s and di start of di 2000s, Madrid don win di UEFA champions league for 1998, 2000 and 2002.

Di latter part of dat three-time champions league winning streak, na di era wey make di label ‘galacticos’ popular. Dem recently win dia 15th title.

As Madrid president Florentino Perez don take ova di club, Portuguese star Luis Figo now move from Barcelona to join di team wey already get ogbonge players.

Dis transfer create tension between di two clubs sake wey Barcelona fans neva take am easy.

Real Madrid go ahead to win dia 15th champions league dis year, di most successful club for European football.

Na so di signing of French star Kylian Mbappe don begin to cause teams to dey shake for Spain and Europe.

Football sabi pipo alreadi begin to compare di latest Real Madrid squad wit Mpabbe to di era of di galacticos.

Remember dis players wey star for Real Madrid for di late 90s and early 2000s

Di galactico era don feature players like Zinedine Zidane, Ronaldo Nazario, Raul Gonzalez, Roberto Carlos, David Beckham and Luis Figo wey join dem from Barcelona.

Madrid also get players like Fernando Hierro and Míchel Salgado.

Florentino Perez declare at di time say im go bring di best players for di world to Spain.

Later, di club decide to combine di signing of global stars togeda wit players from dia academy.

Of course, wit di galacticos, Madrid don win UEFA champions league two times between 2000 and 2003.

Dem also win two la liga titles (2001 and 2003), one UEFA super cup (2002) and two Spanish super cups (2001 and 2003).

During dat time dem also play spectacular football.

But dat era don fade as Barcelona begin to dominate Spanish football wit di arrival of Ronaldinho Gaucho.

Ova di last few years, Real Madrid don begin to dominate European football again wit 6 champions league titles since 2013.

Wit di signing of new players, di world of football begin to shake say anoda galactico era don dey begin, even as ogbonge players like Toni Kroos, Luca Modric and odas dia Madrid careers dey end.

Kylian Mbappe signing and di return of di galacticos?

Real Madrid sign England midfielder Jude Bellingham from Borussia Dortmund for 2023.

Im sign six-year deal afta im win player of di season for Germany.

For im first season for Spain, Jude score 23 goals in all competitions wey im win player of di season as di club win di league and dia 15th champions league.

Jude dey only 20 years.

Im Brazilian teammate Vinicius Junior also get 21 goals for all competitions dis season including one for di champions league final.

Di 23 year-old na di champions league player of di season.

Vinicius na one of di ogbonge players for di Spanish club wey di signing of Mpabbe two days afta dem win dia 15th champions league title dey mean say Madrid go make dangerous next season.

Mpabbe sign five-year deal with di club afta winning six league titles in seven seasons wit French club Paris St German.

Di french forward also be di all-time top scorer for PSG wit 255 goals at age 25.

Im dey join Madrid wit huge reputation wey im go play wit Bellingham, Vinicius and odas.

Brazilian star Rodryggo Goes wey score 15 goals in all competitions for Madrid dis season na anoda ogbonge player, wey im chop 23 years.

Across di field, Madrid dey boast of players wit huge reputation, like Edouard Camavinga (21), Brahim Diaz (24), Arda Guler (19), Aurélien Tchouaméni (24), Federico Valverde (25).

Di oda players Eder Militao (26) and Fran Garcia (24).

Dis na young players wey get planti years to achieve.

For coach Carlo Ancelotti, im wan assemble team wey go dominate world football again.

Di club also don sign Brazilian wonderkid Endrick wey dem expect say im go join di club for July.

Wit di pedigree of all dis players, e dey easy to tink say dis na di return of di galacticos.

And wit di age of dis players, e dey possible say dem go fit to dominate for a long, but na time go be di judge.

Teams for Spain and Europe gatz to begin to shake, especially as lord Mbappe don arrive.

Ancelotti wey go get headache as to how to manage dis ogbonge players, but im be di coach, im sabi dis job well well.

Im go begin by blending Mbappe for dis team.

Di French star already tok say dis move na “dream come true.”

“I dey happy to join dis club, nobody fit understand how happy I dey, I no fit wait to meet di fans”, Mbappe tok.

Source: BBC