BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Latest on Japan earthquake wey don kill ova 40 pipo so far

93263163 Images of some of di damages from di earthquake for Japan

Tue, 2 Jan 2024 Source: BBC

Di number of pipo wey don die for one powerful earthquake wey cause houses to collapse plus make goment give tsunami warning, don increase to 48 for Japan.

Officials for Ishikawa disaster headquarters wey confam dis report say di number fit increase more as rescue effort dey continue.

Around 1,000 rescuers dey search for pipo wey dem tink say fit dey trapped inside collapsed buildings.

Japan Prime Minister, Fumio Kishida, say di earthquake cause plenty casualties and dem dey "race against time" to rescue survivors.

"We have to race against time to search for and rescue victims of di disaster," PM Kishida tok afta one disaster response meeting.

"We don confam very extensive damage, including plenty casualties, building collapses and fires," im say, come add say rescuers dey find am difficult to reach di northern tip of di Noto peninsula.

Some 33,000 households dey face freezing temperatures for night sake of lack of electricity. Many cities also dey without running water.

Japanese military dey give pipo supplies wey include food, water and blankets for pipo wey need to leave dia house.

Earlier, goment bin give warning say one major tsunami fit happun afta one 7.6 magnitude earthquake bin strike di central area.

Now, dem don lift all di tsunami advise along di Sea of Japan, meaning say dem no longer get risk say tsunami go happun.

Di earthquake damage 1,000 houses for di coastal town of Suzu, wit mayor, Masuhiro Izumiya, describing di situation afta as "catastrophic", according to one Reuters report.

Suzu, wey get just 5,000 households, dey located near di epicentre of di New Year Day quake.

Di quake also damage one temple and several graves for di town, local tori pipo NHK report.

Source: BBC