BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Liberia presidential election 2023: George Weah face Joseph Boakai for run-off

42289847 Weah da Boakai

Tue, 14 Nov 2023 Source: BBC

Liberia pipo dey vote for presidential run-off election afta di two leading candidates bin get just 7,000 plus votes for di first round wey happun one month ago.

Dem go choose between di current president wey be one-time football star, George Weah, and former Vice-President Joseph Boakai.

Di president bin narrowly win di first round but fail to get more dan 50% of di vote, triggering the run-off.

Di first round of election wey bin happun for October bin get plenty allegation of fraud and violence.

Di kontri election commission say nine of im temporary staff bin chop arrest over alleged ballot-tampering.

UN bin also report clashes between supporters of rival opposition parties.

Dis na di number four presidential election since di end of di kontri two civil wars wey bin last more dan 20 years, and kill 250,000 pipo.

BBC Moses Garzeawu for Liberia capital, Monrovia, say dem dey expect plenty pipo to show for di run-off election as Liberia pipo dey "hungry to vote".

Weah, 57, wey get 43.8% of di vote for first round, and Boakai, 78, wey get 43.4%, dey try build political collabo wit 18 oda candidates wey run for di first round.

Nobody inside dis 18 oda candidates bin get more dan 3% of di vote.

Boakai wey bin serve as vice-president to Ellen Johnson Sirleaf, Africa first elected female head of state, bin get di support of three out of di four best performing candidates, according to Reuters news agency.

Im focus on investing in agriculture and infrastructure for im election campaigns.

Weah don dey tok about improving education and dealing wit unemployment.

Dis na di second time wey di two men dey face dem sef for presidential election run-off vote.

For 2017, Weah win Boakai wit 61% of di vote for di second round.

Dat time, im popular among di youth as international star and voters bin also dey attracted to im promise to fight corruption, sabi pipo tok.

Polls bin open 8:00am local time (08:00 GMT) and e go close by 6pm local time (18:00 GMT). Na den vote counting go start.

Today second round na a repeat of di run-off election for 2017. Den, George Weah defeat Mr Boakai. E win 61% of di vote.

According to Liberia constitution, di winner of di run-off only need a simple majority to win.

Dem go swear in di winner into office for January next year.

Source: BBC