Nigerian govment don release di malnourished protesters wey bin appear for court last week.
Dis come afta president Bola Tinubu give order for di immediate release of all di minors police bin detain on top accuse say dem follow for di #EndBadGovernance protest wey hold across Nigeria for August.
Di small pikin dem regain freedom on Tuesday afta di court strike out dia cases.
BBC Pidgin monitor how dem hand-ova di minors and oda arrested pipo to di ministry of humanitarian affairs.
Di Attorney General of di Federation bin chook mouth into di matter to make sure say dem immediately release di minors.
According to di president, e direct make di Ministry of Humanitarian Affairs to return di minors to dia families and open investigations as to why dem detain dem for long like.
Wetin happen for court today
Femi Falana, Senior Advocate of Nigeria, wey represent di accused pesins, tok say dem no get any objection to di application.
Justice Obiora Egwuatu den strick out di matter.
Di Minister of Humanitarian Affairs, Nentawe Yilwatda bin also dey for court and na im office take charge of di defendants afta di court release dem.
"We dey here by di directive of di President to make sure say we return di children safely to dis homes. But bifor we do dat we go first keep dem for a facility and check dem to make sure say dem dey medically fit and wia we need to make additional treatment, we go do am," oga Yilwatda tell tori pipo afta di court session.
Fatima Muhammad, mother to two of di detained minors, also tell BBC say she dey fool of joy as her children regrain freedom.
"Alhamdulilah, Alhamdulilah," she tok for Hausa language.
More minors still dey for custody - Falana
For interview wit tori pipo, counsel to di protesters Femi Falana tok say e get oda set of protesters including minors wey still dey custody for Borno and Kano States.
"Yesterday, 19 pipo bin dey charged for Borno State including minors. Again we dey call on di federal govment to discontinue all cases pending in different states wit regards to di August protests," Falana tok.
"I dey also aware dat 16 pipo dey stand trial in Kano. Initially 632 bin dey arraigned bifor a mobile court but today 16 still dey stand trial. We wan make di govment realise di constitutional right of Nigerians to protest, and di criminalisation of protest in Nigeria must stop."
International human rights group Amnesty International also publish a statement for dia X handle to welcome di release of di protesters.
"Di ill-treatments di minors bin dey subjected to – solely for exercising dia right to peaceful protest – don expose a deliberate strategy to crush di vibrant spirit of Nigerian youth and stop dem from demanding accountability, freedom and human rights," di statement tok.
AI also ask President Bola Tinubu to investigate di alleged deliberate starvation of di minors wen police bin detain dem "wey put dia physical and mental health for grave danger".
Who be dis minors?
Di total number of protesters wey di police carry go court dat day na 118, but dem divide dem for two batches of 76 and 42.
Dem later comot di name of four pipo wey bin collapse for court, remaining 114 suspects.
According to di charge sheet of di first batch of 76 defendants, 32 of dem dey below di age of 18; three 14 years, five dey 15 years old, 11 dey 16-year-old, and 13 dey 17-year-old.
Also, di suspects allegedly commit di crime for di FCT, Kaduna State, and Kano States. Na from dis three locations, police take arrest dem.