Wen pesin say dem wan be accountant, pipo dey reason am as di safe choice.
Howeva, Princess Korkor Boateng take am personal wey make am run di Chartered Accountancy programme to become di youngest Chartered Accountant for Ghana.
For May, di University of Ghana hail Ms Boateng for dis achievement wey she get.
At 18, she neva even finish her undergraduate studies for di University of Ghana Business School (UGBS), as she currently dey for her final levels.
She hail her parents say dem "play very important role for my life and my journey to become chartered accountant.
"Dem support me financially, emotionally and mentally and dem always dey dia to assure me for time wey I need help", she add.
Chartered accountants dey different from normal accountant sake of say dem get membership for di professional.
All dis lead am to apply and enta di University of Ghana for her first degree at di age of 14 years old.
She admit say, "I come learn di professional course join my first degree course and na how I come be chartered accountant for age of 18".
Congratulations, Princess Korkor Boateng. We are proud of you.#UGIS75#IntegriProcedamus pic.twitter.com/IkxfAkmM2c
— University of Ghana (@UnivofGh) May 4, 2023
Princess Boateng tok di tori well say, "I face plenti challenges for my journey to become chartered accountant and one of dem na to combine di first degree wit my professional course."
She explain am say, "I gats learn at di same time my academic course and my professional course and e get times wey my exams dey clash wit my tests and quizzes wey I get for school."
Her advise to oda pipo wey dey inspired by her tori be say, "I tink everi bodi get different path to follow, dem get dia own different goals.
"But if you dey very smart and you feel say you fit pursue your goals at a very young age, den I think say make you go for am and no allow anytin to limit you at all."
Road neva end for dis 18 year old undergraduate.
Wen she graduate, Princess Boatend don reveal say her dream job go be to work wit one of di big 4.
As for her long term goal, she say "na to be financial analyst and work for World Bank".