Menu

Melania Trump threaten to sue Hunter Biden for $1bn ova Epstein claim

Melanie Trump 444.png First Lady Melania Trump don threaten to sue Hunter Biden

Thu, 14 Aug 2025 Source: BBC

First Lady Melania Trump don threaten to sue Hunter Biden for more dan $1bn afta e claim say na sex offender Jeffrey Epstein introduce am to her husband.

Lawyers acting on behalf of di first lady, wey marry US President Donald Trump for 2005, describe di claim as "false, disparaging, defamatory and inflammatory".

Biden, son of former US President Joe Biden, make dis comments during one interview earlier dis month, wia e strongly criticised di president former ties to Epstein.

Donald Trump na friend of Epstein, but e tok say dia friendship end in di early 2000s becos di financier wan snatch employees wey dey work at di spa in Trump Florida golf club.

One letter from di first lady lawyers and address to one attorney for Hunter Biden demand make im take back di claim and apologise, or face legal action for "ova $1bn in damages".

E tok say di first lady don suffer "overwhelming financial and reputational harm" becos e repeat di claim.

E also accuse di youngest Biden son of "vast history of trading on di names of others", and repeating di claim "to draw attention to yourself".

During one wide-ranging interview wit filmmaker Andrew Callaghan publish earlier dis month, Hunter Biden claim unrelease documents relating to Epstein go "implicate" President Trump.

E tok say: "Epstein introduce Melania to Trump - di connection dey so wide and deep." Di first lady legal letter note claim, e dey partially attributed to Michael Wolff, one journalist wey write critical biography of di president.

For one recent interview wit US outlet di Daily Beast, Wolff reportedly claim say di first lady sabi Epstein, wey be associate of Trump wen she meet her now-husband.

Di outlet later take back di story afta receiving one letter from di first lady attorney wey challenge di contents and framing of di story.

No evidence say na Epstein introduce dem to each other. Epstein take im own life for prison while awaiting trial in 2019.

Inside di first lady legal letter, e accuse Hunter Biden of relying one article as di basis of im claims, wia dem describe as "false and defamatory".

One message on di archived version of di Daily Beast online story read: "Afta we publish dia story, di Beast receive one letter from First Lady Melania Trump attorney challenging di headline and framing of di article.

"Afta reviewing di matter, di Beast don take down di article and apologize for any confusion or misunderstanding."

Di first lady lawyer, Alejandro Brito, ask BBC News make dem look at one statement wey di her aide, Nick Clemens issue.

E read: "First Lady Melania Trump attorneys dey actively ensure immediate retractions and apologies by pipo wey dey spread malicious, defamatory falsehoods."

One January 2016 profile by Harper Bazaar report say di first lady meet her husband for November 1998, for one party wey di founder of one modelling agency host.

Melania Trump, 55, tell di publication she refuse to give am her phone number becos e dey "wit one date".

Di profile tok say Trump don recently separate from im second wife, Marla Maples, e divorce in 1999. E bin marry Ivana Trump between 1977 and 1990.

Di BBC don contact Hunter Biden attorney.

Di legal letter dey come afta weeks of pressure on di White House to release di so-called Epstein file, previously undisclose documents relating to di criminal investigation against di convicted paedophile.

Before dem re-elect Trump, e tok say e go release di record if e return to office, but di FBI and justice department in July tok say no "incriminating" client list of Epstein associates exist.

Source: BBC