BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

'My breast reduce afta I do breast washing' - Dis therapy dey work?

Screenshot 2024 06 07 103810.png Eniola Oteniara, don share wit BBC her journey to reducing her large boobs through 'breast washing'.

Fri, 7 Jun 2024 Source: BBC

One young woman, Eniola Oteniara, don share wit BBC her journey to reducing her large boobs through 'breast washing'.

Breast washing na traditional practice wey dey popular for western part of Nigeria especially for women wey dey get troublr wit breastfeeding dia pikin dem.

Eniola tok say na her grandmama recommend di therapy for her as she don dey complain say her big boobs dey cause her plenty pain for her back and shoulder.

"My boobs bin dey get too large, I dey always get pain for back and shoulder especially for night. I no dey fit wear bras bicos di handles dey cause me pain," she tok.

"My grandma begin dey tink say I dey use sometin to dey make my boobs bigger, she come dey fear say I fit develop lumps di way my breasts dey enlarge. So she suggest make I go for breast washing."

BBC follow Eniola go Kwara State, North-Central Nigeria, wia one local healer dey carry out di breast washing procedure for plenty women wey dey find her come.

Di healer claim say di procedure dey help nursing mothers wey no dey produce breastmilk well, and also single ladies wey get wahala wit dia breasts.

"As I dey wash di breast, you go dey see di particles dey fall off, afta dat I go give di patient some local medicine wey she go dey take daily, and she go see result," she tok.

Eniola tok say she do three sessions of washing and wia some tins come out from her breast.

"Di first time, plenty tins come out, but for di second and third time, di tins wey come out no too plenty like di first time," she tok.

"Afta di washing, my pores open and tins come out. Since den my boobs don really change, e no dey heavy me as before."

Mohbad death - US lab give update on autopsy check, result

Families demand answers from police over disappearance of Celine and Afiba

Baby Elsa na di third pikin wey di same set of parents dey born den troway

Breast washing get any scientific backing?

However, BBC tok to Habib Lawal wey be medical expert, im tok say "e no get any type of breast washing wey go comot lumps for breast".

Lawal tok say di breast washing na just like to stimulate di hormones, maybe to produce milk, but e neva dey scientifically proven.

"But for lumps, e no tally at all. A lump na internal defect, but breast washing na somtin external, so e no get any scientific connection at all," di doctor tok.

"Breast cancer na one of di common causes of cancer deaths for women in developing kontris including Nigeria. And we dey advocate for women, young and old, to dey undertake self breast examination at least every six months.

"Immediately pesin notice a lump, dat na opportunity to kiakia go to di hospital make dem examine am to find out weda di lump dey cancerous. And if na cancer, di earlier di pesin start treatment, di beta."

Dr Lawal tok say e no dey advisable for breastfeeding woman to go wash breast, becos e fit make di nipple dry and cause cracks.

"Nursing mother wey no dey produce milk well well suppose go hospital or meet a trained midwife and dem go get help," Lawal tok.



Breast washer dey attend to anoda client

Source: BBC