Wunmi Aloba na di wife of late musician, Mohbad
Wunmi Aloba wey be wife to di late Nigeria music star Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad say di death of her husband pain her becos say e be like win to some pipo.
Wunmi wey follow BBC Pidgin tok for exclusive interview say di death of her husband pain her so much becos e struggle to stay alive but unfortunately, e still later die.
She also torchlight many oda issues wey concern her husband death, including di tok tok about issue of DNA for dia child.
Singer Mohbad die for 2023. Dem bin bury am almost immediately but authorities later dig out di body to find out wetin kill am.
"My husband no dey too tok, im death na like win for some pipo. E pain me say at di end of di day my husband die," Wunmi tok.
Wunmi tok say na Mohbad papa bin take di decision to bury am second day wey e die.
"Evribodi beg am make e no bury my husband but e no gree. Im tok say Im go bury am, e call di Baale wey dey di area but dem tell am say im no fit bury pesin for night".
Mohbad death na one wey touch many Nigerians and spark a call for justice following reports wey allege say e suffer bullying, harassment and assault as a musician wey bin dey signed under di music label Marlian records.
'I no sabi Naira Marley before'
E get tori say Wunmi bin sabi Naira Marley, di CEO of Marlian records wey Mohbad bin dey with bifor e sign Mohbad to im records.
Wen we ask Wunmi if na true, she say she neva meet Naira Marley bifor e sign im husband.
"I no sabi am, di first time wey I see am wit my two eyes na di third day wey e sign my husband".
'I no get issue with DNA'
Wunmi also chook mouth inside di issue of im son, wey di father-in-law Joseph Aloba dey demand to do DNA.
"I don ready for dis DNA since November 2023, I no get any issue wit DNA but my father-in-law no do di needful.
My lawyer tok say di best to do na to do di DNA becos say na im be di tool wey e dey use fight me."
Wunmi tok say na her father-in-law dey hold di DNA from happening, but dem go go court to get order so dem go fit take sample of Mohbad tissue to go do di DNA.