Nigeria Labour Congress (NLC) don suspend di nationwide strike wey dem bin plan to start on Wednesday sake of di increase in di prices of fuel due to subsidy removal.
After hours of meeting wit di goment, President of the NLC, Joe Ajaero on Monday night confirm to BBC say dem make di decision in order to enable further consultations.
Di NLC and di Trade Union Congress, dey expected to kontinu negotiations wit di goment.
Increase on minimum wage and tax holidays for workers na some of di demands di labour unions dey ask from di goment to protect against di effect of wetin subsidy removal don cause.
Last Wednesday, fuel marketers increase di price of petrol to at least $1 per litre across di kontri - up by about 200%.
This has affected the cost of transportation, food items and other commodities, while the minimum wage is about 65$.