Some Nigerian National Petroleum Company Limited filling stations don adjust dia fuel prices.
Most NNPC filing stations for Lagos, Nigeria commercial city and di Federal Capital Territory no dey sell 897 naira ($0.52) per litre fuel again.
BBC News Pidgin tori pesin see say di national oil company don adjust dia fuel price to 998 naira ($0.52) for Lagos and 1,030 for Abuja.
NNPLC neva tok anytin about fuel increase but dis na di third time wey dia filling stations go increase fuel price – dis na di second time within one month.
In September di Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPC Ltd release wetin dem say be di estimated pump price of petrol across Nigeria based on September 2024 pricing from di Dangote refinery.
Dis come as Dangote begin dia first petrol loading from dia Refinery.
For di statement dem release, di graph wey dey attached show say some states go buy from N950-N1200. But just about a month afta, di prices don change.
NNPC estimated pump price as at September
Lagos - 950. 22 naira per litre
Oyo - 960.22 naira per litre
Imo - 980.22 naira per litre
Rivers - 980.22 naira per litre
FCT - 992.22 naira per litre
Kaduna - 999.22 naira per litre
Kano - 999.22 naira per litre
Sokoto - 999.22 naira per litre
Borno - 1,019.22 naira per litre
Nigerians reacts to new petrol price
Many Nigerians no happy about di increase in fuel price, di news come as shock to dem.
Some take to social media to express dia feelings like Aliyu Halimsaliyah wey tok for X say, ’’na every market day fuel dey high since di protest’’
While Laface say, "pipo like Mele Kyari suppose resign and leave dat office dem be total failure".
For Chris @CEO_Chrysolite e say, ''im meet fuel at N195 afta a year and some months now na N1030''
Activist Deji Adeyanju say, ''fuel now na N1,030 but nobody want to chase clout by protesting. Everybody dey wait for pesin to start protest''.
Vreng @its Vreng say, ‘’Nigerians na di only pipo on earth wey dey barely pay tax, but expect US standard of facilities and subsidies’’.
@Uncle_Fineboy @FineboyUncle say ‘’T-pain you dey do well, raise am raise am raise am, next time wen we speak, una go hear word. till 2031’’.