BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Na some politicians dey use protesters cause confusion for Nigeria - Shettima

Screenshot 2024 08 09 150301.png Nigeria's vice President Kashim Shettima

Fri, 9 Aug 2024 Source: BBC

Nigeria Vice President, Kashim Shettima, don tok say di Nigerian president dey serious about helping pipo for northern Nigeria, but some pipo dey cause wahala.

Shettima tell BBC dis one on Thursday.

Dis dey come as some states for di North witness some level of looting and violence during di nationwide protests wey begin for 1 August.

Northern states goment such as Kano, Yobe, Kaduna, Jigawa impose curfew on di residents afta reports of looting and violence during di protest.

Di vice president yarn say President Bola Ahmed Tinubu know wetin di pipo dey face, and im dey feel for dem. "By di grace of God, di goment don dey work on plans to make sure our pipo get better support."

Shettima mention say di goment don take some steps, wey include sharing 42,000 tons of grains to help di pipo and also dem increase di minimum wage from 30,000 to 70,000 Naira.

On goment plan to support farming, e say dem don put 100 billion naira for ground wey go reach five million farmers. E add say di support don start already, like for Jigawa, wia dem don plant wheat for almost 65,000 hectares, and dem go also support farmers for dry-season farming wey go start for November.

Shettima add say dia goment dey try bring peace for di kontri, especially for di Northwest. "We don see small improvement for Borno and Yobe."

Di vice president also accuse some politicians say dem dey use di protests wey dey happun sake of hardship to cause confusion for di country.

"We know say pipo dey worry for di country, but di truth be say, some pipo don join di protests with dia hidden agenda. Some politicians get dia own plans to cause wahala and throw di country into crisis wey go hard us to come out from."

During di protests,di Chief of Defence Staff (CDS) General Christopher Mustapha bin caution dose wey dey fly di Russian flag, say e be treasonable offence afta some protesters for di northern region of di kontri wave di Russian flags during dia demonstration.

Di CDS describe di move as unacceptable, while di Department of State Services (DSS) tok say dem don arrest some tailors wey dem suspect dey mass-produce di Russian flag for Kano State.

For one statement on Monday, di DSS also tok say some of di sponsors don dey apprehended.

Meanwhile, Shettima assure say dem still dey serious to help di pipo, even though life hard. But e also tok say goment get responsibility to protect pipo lives and properties.

Kashim reject di tok wey some pipo dey tok say dia goment dey do favouritism, especially for di way dem dey share appointments in kontri. E say na just politics. "Out of 46 ministers, 24 dey from di North.

Shettima also tok say for di kontri budget, Tinubu don give plenty money to security, education, and health sectors. E add say dem still dey plan to build houses for pipo wey violence don chase from dia homes for di North.

Source: BBC