Nigerian gospel minister, Nathaniel Bassey go minister for di US Presidential Inaugural Prayer Breakfast on 20 January, 2025. Dis na on di morning of di inauguration of president-elect Donald Trump.
Di non-political and faith-based event go hold for Waldorf Astoria Presidential Ballroom, Washington, D.C in honour of President-elect Donald Trump and Vice President-elect JD Vance bifor dia swearing-in ceremony.
Na Reverend Merrie Turner be di host of prayer breakfast.
Odas wey go perform for di event na Pastor Mario Bramnick, Revivalist Rebecca Macchi and Dr. Dominiquae Bierman dem go minister for di event.
Nathaniel Bassey wey be di only Nigerian and African artiste confam im invite ontop im Instagram page on Sunday.
Di event dey hold every fours years for every new administration in di United States.