Menu

New York Attorney General Letitia James don dey criminally indicted

Letitia James.png New York Attorney General Letitia James

Fri, 10 Oct 2025 Source: BBC

New York Attorney General Letitia James don dey criminally indicted on federal charges by one grand jury.

James wey bin hold one civil fraud investigation against Trump for 2023 bin dey indicted for charges of bank fraud for di Eastern District of Virginia for Alexandria, dat na wetin court documents tok.

Prosecutors dey accuse James of alleged bank fraud and say she make false statements to one financial institution for loan to buy house for Norfolk, Virginia, na wetin di documents tok.

For statement, James accuse di president, wey recently dey gigner di prosecutors for public to file criminal charges against am say e dey do "desperate weaponization of our justice system."

"E dey force federal law enforcement agencies to do as im like, all bicos I do my work as di New York State attorney general", na wetin she tok.

"Dis charges dey baseless and di president own public statements show say im goal na political revenge at any cost".

Di US prosecutor wey dey run di case, Lindsey Halligan, howeva tok say wetin di case show

"Di facts and di law for dis case dey clear, and we go continue to dey follow dem to make sure say justice dey served," she tok.

Trump bin appoint Halligan wey bin work as im former personal attorney, to oversee di mata afta anoda US prosecutor Erik Siebert bin resign.

Tori be say Siebert comot afta e bin tell di justice department e no find enof evidence to charge James.

James first court appearance go happun for 24 October for Norfolk.

Di federal govment case na say allegedly James bin buy three bedroom house for Norfolk wit mortgage loan wey she say she go use di secondary residence but instead dem "use am as rental investment property", wey dem rent out to family of three.

Prosecution claim say di "misrepresentation" allow James get beta loan terms wey she for normally no get for investment property.

Halligan tok say if dem convict James, she fit face up to 30 years for prison per count and fine of up to $1 million for each count.

James lawyer, Abbe Lowell tok say, "we dey very worried say na President Trump revenge desire na im dey ginger dis case".

Last month, Trump bin hala US Attorney General Pam Bondi wey dey lead di justice department, for social media post to prosecute im political opponents, wey include James.

E write say, "we no fit delay again, e dey kill our reputation and credibility".

James na one of di plenti Trump opponents wey im bin call for di post. E also call Bondi make e also investigate former FBI Director James Comey and dem criminally charge am shortly afta. E bin plead not guilty on Wednesday afta dem bin charge wit making fake statement for Congress.

Tori be say di justice department bin also open investigations on top of Trump ex-national security adviser John Bolton and California Democratic Senator Adam Schiff.

For di civil fraud case wey James bring against Trump, dem bin find di president liable say e fake records to get beta loan deals wey lead to fine of $500m. Appeal court troway di penalty say e dey excessive but dem sha tok say Trump bin dey liable for fraud.

As di case bin dey progress dey go, Trump hold James for mind dey attack am outside of court say she dey do "political witch hunt" against am. James tok say di courts bin rule say Trump "no dey above di law".

On Thursday, James tok say she tanda gidigba behind her office litigation against Trump and im organisation.

New York Govnor Kathy Hochul wey be Democrat hala say James indictment "no pass weaponization of di Justice Department to punish di pipo wey dey hold di powerful accountable".

Di New York Civil Liberties Union and American Civil Liberties Union call am "di latest for long list of brazen abuses of power by President Trump".

Source: BBC