BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Niger arrest soldiers afta coup attempt near Presidential Palace

 117770967 Mediaitem117770963 File foto of di frontal view of di Niger Presidential Palace

Wed, 31 Mar 2021 Source: BBC

Niger authorities don arrest soldiers wey get hand for di attempted coup wey happun for di kontri Presidential Palace on Wednesday morning.

Less dan two days to di inauguration of im new president Mohamed Bazoum, di presidential guards bin block di attempted coup wey one army captain lead for early momo on Wednesday, but tensions still high for di kontri capital Niamey.

Heavy shooting for di Presidential Palace for area wia president office and house dey na im wake pipo up around 3am on Wednesday morning and e last for 15 minutes before e stop.

Although dem neva release any official statement, security sources wey confam di attempted coup to BBC say dem don arrest di soldiers wey get hand for di mata.

Since President Bazoum win election for February, attacks from armed militant groups don increase and political tensions dey high.

Im challenger, former President Mahamane Osumane, wey loss for di runoff election bin reject di results.

Authorities bin ban opposition groups plan to enta road on Wednesday do i-no-go-gree.

Niger wey be one of di poorest kontri for world, don get long history of military coup and increasing deadly attacks from jihadist groups.

Source: BBC