Menu

Nigeria beat Ghana for corruption as island nation maintain status as least corrupt African kontri - CPI report

Mahama And TINUBU.png President of Ghana John Mahama (Left) and President of Nigeria Bola Tinubu

Tue, 11 Feb 2025 Source: BBC

Corruption Perception Index for 2024 wey Transparency International release on Tuesday 11 February show say Nigeria score 26 out of 100 points and rank 140 out of 180.

Dis latest report show say Ghana score 42 out of 100 points and rank 80 out of 180. Wetin e mean be say Nigeria corrupt pass Ghana.

Oda kontris wey also score 26 points wit Nigeria include Uganda, Mexico, Madagascar, Iraq, and Cameroon.

For di report, Denmark na di least corrupt kontri as dem score 90 points. Finland na second as dem score 88 points, and Singapore come third as dem score 84 points.

Na European kontris dominate di top 10 veri clean list and no African kontri dey inside.

Meanwhile, na Seychelles top di list of least corrupt African kontris as dem get 72 points out of 100 and rank 80 out of 18.

Na Cape Verde follow Seychelles for back as dem get 62 points out of 100 and rank 35 out of 180.

South Sudan, Somalia and Venezuela na di most corrupt kontris for 2024.

"Di 2024 Corruption Perceptions Index (CPI) show say corruption na dangerous problem for evri part of di world, but change for di beta dey happun for many kontris," di chair of Transparency International, Francois Valeria, tok.

"Research also reveal say corruption na major threat to climate action. E dey hinder progress in reducing emissions and adapting to di unavoidable effects of global heating."

Di CPI dey rank 180 kontris and territories worldwide by dia perceived levels of public sector corruption.

Dem dey give di results on a scale of 0 (highly corrupt) to 100 (veri clean)."

Valeria tok say while 32 countries don significantly reduce dia corruption levels since 2012, work still dey to do.

According to Valeria, 148 kontris don remain for di same spot or get worse.

"Di global average of 43 don stand still for years, while over two-thirds of kontris score below 50. Billions of pipo live in kontris wia corruption dey destroy lives and undermine human rights," Valeria tok.

Source: BBC