Di Nigerian Minister for Interior Olubunmi Tunji-Ojo don drive some positive changes for passport
Di Nigerian govment don give new announcement ontop di increment of international passport fees.
Di govment make dis announcement on Thursday 28 August 2025 for dia statement.
Di increment go affect the five and ten years validity, and di 32 and 64 pages passports.
Wetin be di new Nigerian passport application fees
Di new Nigerian passport application fees go only affect passport application wey dem make for Nigeria.
- For di 32-page wit 5-year validity, di new price na 100,000 naira,
- For di 64-page wit 10-year validity, di new price na 200,000 naira.
Meanwhile, dose wey outside Nigeria wey de apply for di Nigerian Passport, di application fees no change..
NIS say passport application fees by Nigerians wey dey diaspora dey unchanged at di price of $150 for 32-page wit 5-year validity and $230 for 64-page wit 10-year validity.
Why di NIS increase passport application fees and wen e go start
According to di Nigeria Immigration Service (NIS), di fee increment go affect passport application wey dem make for Nigeria.
Dis Immigration tok tok pesin, ACI AS Akinlabi announce say di new passport application fees go start from 1 September 2025.
E say dem make di increment becos dem wan quality of di Nigerian passport.
"For di bid to uphold di quality and integrity of di Nigerian Passport, di Nigeria Immigration Service hereby announce upward review of Nigerian Stardard Passport fees"
Di Immigration service also add say dia commitment na to balance 'quality service delivery wit di need to ensure say Passport services dey accessible to all Nigerians.'
Changes for passport application process
Within di past one year, some positive changes don happen for di passport application process for Nigeria, as multiple sources confirm.
For June 2023, BBC Pidgin interview di acting Comptroller General of Nigeria Immigration Service, Adepoju Wuraola, and one di tins she promise to do for office na to “overcome all di problems wey Nigerians dey face bifor dem fit collect dia passport”
Also, di current Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, bin assure BBC Pidgin for anoda exclusive interview say im top priority na to digitize di passport application process and make am almost autonomous.
For dat interview, oga Tunji-Ojo say dem dey target di time from wen pesin apply for passport to wen e go receive am to be between two and three weeks.
"Realistically we dey target two weeks (to renew and get your passport) but for some places, e still dey take like three weeks but for me, wit di reforms wey we dey bring onboard in di next couple of weeks, even di two weeks go dey too long, so we dey look at one week." E tok dat time.
According to Tunji-Ojo, di only tin wey go carry pesin go Immigration office for passport application na di biometric data capture process, “evri oda tin na for di Immigration website you go do am”.
Pipo wey dey apply for renewal of passport and pipo wey wan effect change of name or date of birth or any mistake for dia personal data, go also fit do am for di website witout going physically to di Immigration office.
Bifor now, to apply for passport dey take several months, and some immigration officers bin dey accused of extorting moni from pipo to fast track dia application.
How to apply for Nigeria passport
Di website to apply for Nigeria passport na 'passport.immigration.gov.ng', and di following na requirements for person wey wan apply for fresh passport, for adult and minor:
.Letter of identification from Local Government/State of origin or residence or National Identity Card
.For goment eployees: Letter of introduction stating Service Number, Length of Service and Designation/Rank.
.Valid staff ID card
.Completed passport application form
.Marriage certificate, where applicable.
.Birth Certificate (Pipo wey dem born from December 1992 must to submit certificate by di National Population Commission)
.Pesin wey no get birth certificate go provide age declaration document endorsed by a Commissioner for Oaths, wit one passport-sized photograph
Acknowledgement Slip and Evidence of Payment.
For Minors
.Completed passport application form, wit 1 passport-sized photograph to be endorsed on di oda side by di consenting parent(s).
.Evidence of Nigerian citizenship of parent(s).
.Birth certificate (certificate must be issued by the National Population Commission for minors wey dem born for Nigeria).
.Letter of consent from either parent.
.Acknowledgement Slip and Evidence of Payment.
.For child wey dem adopt, di parent(s) go provide court order and letter of approval from di Ministry of Women and Child Development