BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Nigerian child dancer wey im barefoot video go viral, meet Camilla

Di child dancer meet Lady Camilla

Wed, 15 Mar 2023 Source: BBC

Camilla, di Queen Consort meet one young Nigerian ballet dancer wey get a scholarship afta im video go viral.

One video of Anthony Mmesoma Madu wia im dey dance barefoot in di rain for Lagos get pass ova 16 million views.

Camilla speak wit di 13-year-old, during one visit to Elmhurst Ballet School for Birmingham.

She wish di second-year student luck wit one forthcoming Disney documentary wey wan tell im tori.

Wen she ask am if e don always like to dance, di young star reply: "Yes, since I bin dey five years old."

"e get to grip wit you, you no fit let am go - good luck," Camilla reply.

Disney bin announce documentary about di boy, wey im family dey live on di edge of di Nigerian capital, for September.

Speaking afta di visit, Anthony say im don adapt well to life for di UK, even as im find am "still quite cold".

"My dancing dey go well, e dey really, really great, and I dey really enjoy am," e tok.

"I just hope say younger dancers from anywia around diworld... I just hope to inspire dem to pursue dia dreams and never give up," e add am.

Di Queen Consort, wey be patron of Elmhurst, unveil one plaque during her visit to mark di school centenary, and speak to oda students, staff and alumni.

Later in di day she visit Southwater Library for Telford to thank charity volunteers for dia outreach work, including East Shropshire Talking Newspaper and one food bank.

She also unveil one plaque wey she place on a veteran trail for di nearby Town Park.

Chair Erica Hanson-McKenzie say di trail represent one "forgotten community" of living veterans.

"Dis plaque mean so much to me dat wen dem tell me about am, honestly, I almost cry," she add.

Source: BBC