BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Nnamdi Kanu released? Experts explain wetin appeal court judgement mean for di Ipob leader

60729663 Nnamdi Kanu, leader of pro-Biafra group IPOB plus im lawyer

Thu, 13 Oct 2022 Source: BBC

Court of Appeal for Abuja on Thursday discharge and acquit Nnamdi Kanu, di leader of di Indigenous People of Biafra, Ipob, of di charges wey federal goment sama for im head. Justice Jummai Hanatu wey lead di three-man panel tok say Kanu no get any case to ansa again as di Federal High Court no get jurisdiction to try am in di first place. Court rule say as dem drag Kanu come Nigeria by force dey illegal becos dem no follow extradition process. Court also tok say to detain or try Nnamdi Kanu dey prohibited by law. With all dis tins wey di Appeal Court for Abuja tok, pipo dey ask question weda Nnamdi Kanu don dey free to go house. Wetin di ruling mean? Abuja based Human Rights Lawyer Samuel Ihensekhien try to breakdown di ruling for kontri pipo to understand. Barrister Samuel tell BBC Pidgin say im dey salute di courage wey di Appeal Court get to give dis judgment, and wit wetin di Appeal Court tok, Nnamdi Kanu dey free to go im house. E explain say wen pesin or pipo no take due process to follow law or comply wit di existing law di consequence be say e go render di whole proceedings illegal. "Di capture of Nnamdi Kanu back to Nigeria dey against di Nigeria extradition Act, e dey against di African Charter of pipo and Human Rights, e also dey against evri law wey dey govern international law. "Before you extradite anybodi or a citizen from any Akrican Kontri you must face follow di extradition laws of di kontri and follow di due process of di court, na until di court give you permission you fit return di pesin to face any trial for im kontri" "But for dis case, we just hear say Nnamdi Kanu surprisingly appear for Nigeria like angel, no procedure, no documentation, no official record. E add say wetin court do be say, dem uphold di extra-ordinary rendition, wia dem dey arrest citizen from one kontri, cari dem go anoda kontri without due process. Oga Samuel tok say Nigeria goment no get any choice now oda dan to let Nnamdi Kanu go. "As e be so, Nnamdi Kanu na freeman , court don pronounce free, so im dey free, federal Goment no get any choice oda dan to comply with di court of appeal ruling." e tok. Wetin fit happun next? Barrister Samuel Ihensekhien tell BBC Pidgin say di only option for federal goment now na to cari di mata go Supreme Court, but even if federal goment go cari di mata go supreme court, dem go first obey di judgement of di appeal court. "Dis na case wey bother on di liberty of a citizen, dem need to comply first with dis judgement before dem take any oda step, becos e go dey wrong to still detain am wen court don discharge am of all di charges" e tok. Meanwhile member of Nnamdi Kanu Legal team, Aloy Ejimakor tell BBC Pidgin immediately afta di ruling say "wen we kolet di judgement paper tomorrow(Thursday) we go serve Department of State Security (DSS) so dat dem go release am sharp sharp, as e be so, Nnamdi Kanu na free man" Aloy tok. Federal goment lawyer David Kasuwe no tok to tori pipo afta di judgement. Di Seven-Count charges wey Nnamdi Kanu bin dey appeal Nigeria goment bin sama di proscribed Ipob leader 15 count charge wey border on terrorism, treason, secession and dat im be member of IPOB group wey goment don outlaw. But for May 2022, Justice Binta Nyako of di Federal High Court remove some of di charges from 15 to seven. Na di remaining charges below di appeal court throway on Thursday. Count 1: Say Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to intimidate di population. Count 2: Say Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to threaten members of di public wit sit at home order. Count 3: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e declare imsef as member and leader of Ipob, group wey Nigeria goment don ban. Count 4: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage members of di public to kill Nigeria security officers. Count 5: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage di public to attack officers of di Nigeria police force. Count 13: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage members of di public to burn down evri federal goment facility for Lagos wey lead to major economic loss to federal goment. Count 15: Say Nnamdi Kanu import Radio transmitter known as Tram 50L and hide am inside container for Ubulisiuzor for Ihiala Local government area of Anambra. Nnamdi Kanu case so far Who be Nnamdi Kanu? Nnamdi Kanu na Nigerian separatist leader and founder of di Indigenous People of Biafra (Ipob), one group wey want a breakaway state for south-east Nigeria. E found IPOB for 2014. Kanu grow up for south-east and attend di University of Nsukka. E move to di UK before graduating. Soon afta e set up Ipob, e speak to gatherings of di large Igbo diaspora, calling for Biafran independence. For some some of im comments, e ask Biafrans to take up arms against di Nigerian state. "We need guns and we need bullets," e bin tok for one of such address. And dat na wetin bring am to di attention of Nigeria security services. Kanu dey seen by many as a dangerous propagandist, but e dey also consider as a lightning-rod for di way many Igbos still feel unhappy about Nigeria, years afta a three-year civil war between 1967 and 1970. Authorities arrest Nnamdi Kanu for 2015 wen e return to Nigeria but dis only boost im profile. Di man wey many Nigerians bin dismiss as troublemaker, even within im ethnic group, become di most talked about Igbo pesin. Kanu form di Biafran Security Services (BSS), one mock militia wey dey dress in black and do parades for di eastern city of Abia, im home state. As di Nigeria goment see say im group dey overdo too much, court come declare Ipob as terrorists group and ban dia activities. For September 2017 di Nigerian army carry out one raid for Kanu house but e escape. Many bin tink say dat na di end, but Kanu reappear for Europe for 2018 and continue di radio broadcasts wey e bin don dey do before For late 2020, e resurrect di BSS and rechristen am di Eastern Security Network (ESN).

Source: BBC