Di management of Adekunle Ajasin University don react to di death of two of dia students
Di management of Adekunle Ajasin University Akungba Akoko for Ondo State, southwest Nigeria don react to di death of two of dia students wey jaguda pipo allegedly kidnap and murder.
Di university for statement tok say no student deserve to die in dia pursuit for education, and nobody get right to cruelly murder dem.
Dem also add say, "Security operatives dey do dia best to provide beta security and dey collabo wit oda state security apparatus to fish out dangerous elements from di community".
Dia reaction dey come afta Ondo State Police Command confam say dem don arrest three pipo in connection wit di alleged abduction and killing of di two students.
Na for 20 June, colleagues of Andrel Okah wey dey di Department of History and International Studies and John Abba of di Department of Economics, bin declare dem missing.
Dia disappearance bin spark widespread concerns for di university as nobody sabi dia whereabout.
Landlord of one of di students two odas suspects arrested - Police
On Thursday, 17 July, di Ondo State Commissioner of Police Oga Adebowale Lawal, for one press briefing tok say dem don arrest di landlord of one of di deceased, on top accuse say e get hand for di crime, plus two odas.
For statement, di CP say, "Following a petition dated June 24, 2025 wey G.O. Omoedu & Co., Legal Practitioners submit on behalf of one Mr Emmanuel Peter of Shagari Village, Akure, Ondo State, di command launch one intensive investigation into di reported abduction of im younger brother, one Abah John Friday, 25, and im friend, Okah Andrel Eloho, 19, both students of Adekunle Ajasin University, Akungba-Akoko, wey go missing on June 20, 2025."
E explain say wen dem receive di missing pesin complaint, dem begin investigation wey lead to di arrest of di suspects.
Di police oga explain say one of di suspects Ojo Michael don confess say e participate for di robbery, abduction plus eventual murder of di victims.
E further disclose say na one Oladele Femi wey be di landlord of di male victim allegedly engage am to do di work.
"Michael also admit say im rape di female victim. Dem execute her along wit her friend wen she unmask im identity so dat she no go expose dem," di CP tok for di statement.
Di CP add say dem also arrest Oladele Femi, wey during confess say na im dey behind di crime.
Acting on dis confession, detectives bin recover di body of di female victim for inside one bush near Ode-Ekiti, and dem don deposit am for General Hospital Mortuary for autopsy."
Di police boss also say dem dey try recover di remains of di male student, "wey dem believe say one of di accomplice wey still dey at large dump im body for river." who is believed to have been dumped in a river by an accomplice still at large."
Di case of abducting students no dey new for Nigeria.
According to one verified UN report, in di last 10 years, conflict-related violence don lead to di abduction of more dan 1,680 children from school and elsewhere; 180 children don die sake of attacks on schools; an estimated 60 school staff kidnapped and 14 killed; plus more dan 70 attacks on schools.