Menu

October 7: Two years afta Hamas attack on Israel, wetin don change?

Jhgjkkf.png A woman dey cry sake of loosing a loved one

Tue, 7 Oct 2025 Source: BBC

Two years afta di Hamas attack on Israel, many tins don change around di world wit di Israel-Gaza war right now.

Dis na as plenti kontris for world don recognize Palestine as dia own state.

Di United Nations Palestinian refugee agency (UNRWA) don reveal say ova 66,100 pipo don die wey include about 18,430 pikin dem.

Almost 80% of di buildings for Gaza Strip don dey damaged or destroyed.

Less dan 40% of hospitals still dey work and all of dem dey work partially.

Di mata now na say negotiators dey meet for Egypt to for indirect tok-tok as to how dem go fit end di wars.

UK Prime Minister Keir Starmer dey ask di kontri pipo stidents make dem no join di pro-Palestiniam protests for di second annivarsary of di attack.

Starmer say e dey un-British to do protests as e tok say some pipo dey use am as "despicable excuse to attack British Jews".

Meanwhile US President Donald Trump tell tori pipo as di indirect peace tok-tok dey happun for Egypt say na "very good chance" say dem go make peace deal.

E add say Hamas don gree to "very important" tins for di toks.

Wetin happun for 7 October, 2023?

Di invasion wey happun on 7 October fit dey considered as di most serious attack wey don ever occur across di border, wey Israel don face for more dan one generation.

Members of Hamas cross di fence wey separate Gaza from Israel from many different places.

Dem raid villages, kill at least 1,400 pipo. Di estimate be say dem kidnap nearly 200 pipo.

Fighters bin also fire thousands of rockets from Gaza Strip, some of dem hit cities as far as Tel Aviv and Jerusalem.

In response, Israel launch several bombs against di Gaza Strip di following days afta.

According to di UN, on reveal say ova 66,100 pipo don die for inside di kasala.

Families for Israel wey bin dey affected be di 7 October attacks tok dia mind wit wetin dey happun two years on.

One former hostage Eli Sharabi bin find out afta dem release am following 491 days wey dem lock up say im UK-Israeli family bin dey killed for di attack.

As at now Hamas still dey hold im broda bodi wey dem also kidnap and e dey wait make dem free im friend Alon Ohel wey dem gold wit am dia.

Dis na as Israelis for Jerusalem join march to call for di return of di hostages.

Dalia Cusnir wey be di sister in law of Eitan Horn wey bin dey kidnapped and dey believed to be among di 20 hostages wey still dey alive.

She say dem kidnap am wit im broda wey bin dey released for ceasefire deal dis year apparently e tell di family make dem go on wit dia lives and be happy.

Meanwhile Hamas don drop statement say nothing fit legitimize di killings of innocent Gaza citizens for di Strip wey don dey happun across di two years kasala.

Wetin be Trump plan for di Gaza peace deal

President Trump get 20 point peace plan wey Israel don gree to and Hamas don partially gree to.

Di plan na just framework and e no even really dey dat long but some of di koko tins wey remain to handle na

Hostage release: Hamas don gree say dem go exchange hostage wey dey Trump plan but wit some "field conditions". But bicos e dey believed say only di hostages di group get to use negotiate, e neva sure weda dem go gree release dem bifor dem finalise evri-evri.

Hamas disarmament: Israel Prime minister Benjamin Netanyahu don dey hala say e no go stop till di group don scata pata-pata and even Trump plan dey call for dem to disarm. Howeva, Hamas no tok anytin like dat for dia response to di plan.

Future leadership of Gaza: Di plan be say for now govment for Gaza go be by transitional bodi of Palestinian technocrats togeda wit international leaders bifor dem go carry am give di Palestinian Authority (PA) but Netanyahu dey push back against dem to get hand for di Strip.

How Israel go comot: Di plan from di White House proposal from Israel to comot wey dem show in three stages no clear and no give clear timelines on wen exactly dem go comot.

Di way di tok-tok dey go be say no be face-to-face meeting between di two warring side. Wetin dey happun be say mediators from Qatar, Egypt and di US dey run between both sides wit tok-tok.

Di hope be say dem go draw up deal wey go allow di implementation of di first phase of Trump 20 point plan to end di fight-fight for Gaza.

Anoda hope be say dem go fit get di release of di 48 remaining Israeli hostages of which e dey believed say only 20 still dey in exchange for di hundreds of Gazans wey dey detained, according to wetin di Palestinian and Egyptian officials tell BBC.

Source: BBC