BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Osun election tribunal: Make our pipo calm down - Ademola react to sack

Senator Ademola Adeleke

Fri, 27 Jan 2023 Source: BBC

"I swear to challenge di ruling for di Court of Appeal."

Dis na di reaction of di Osun state govnor, Senator Ademola Adeleke afta di election tribunal wey siddon for Osogbo, di state capital nullify im govnorship position.

Di govnor for inside statement wey im tok-tok pesin Mallam Olawale Rasheed sign say di judgement of di tribunal na "miscarriage of justice" and im go challenge di judgment for di Court of Appeal.

Di Osun State governorship election petition tribunal bin declare Abiodun Oyetola as winner of Osun govnorship election wey happun for July 16, 2022.

Di tribunal wey justice Tertsea Kume lead say na di former govnor be di winner of di election.

Governor Adeleke wey react to di decision of di election tribunal from im kontri home for Ede fault di resolution of di over-voting question in favour of Mr Oyetola, e say na " an unfair interpretation against di will of majority of voters"

"I call on our pipo to remain calm. We go appeal di judgement and we dey sure say we go get justice. Make our pipo dey reassured say we go do everything possible to retain dis widely acclaimed mandate", Governor Adeleke declare.

Source: BBC