Menu

Overstay fit lead to deportation and life ban - US Embassy warn

AMERICAN VISA Di USA say overstay fit lead to deportation and life ban

Tue, 15 Jul 2025 Source: BBC

Di United States Mission for Nigeria don send strong reminder give Nigerians and oda foreigners wey dey plan or already dey U.S, make dem no overstay dia visa or di time wey immigration give dem to stay.

For one statement wey dem post for dia official social media page, di U.S. Embassy tok say anybodi wey stay pass di allowed time wey dem give am for U.S. fit face serious wahala.

"If you remain for di United States beyond your authorized period of stay, you fit be deported and fit face a permanent ban on traveling to di United States for di future" di Embassy take tok.

Dis warning na part of wetin U.S. immigration pipo dey do to make sure say pipo dey obey visa rules and to stop pipo wey wan misuse dia visa.

Under U.S. immigration law, if pesin overstay im visa for more dan 180 days but e neva reach one year, dem fit ban am from coming back to U.S. for three years.

If pesin overstay for more dan one year, di ban fit reach 10 years. And if e worse pass like dat, di pesin fit chop permanent ban meaning say e no go ever fit enta U.S. again.

U.S. officials still tok say make all visitors dey check di time wey dem suppose stay, and make dem arrange to comot befor di visa or entry time expire.

Dis statement na serious reminder for anybodi wey dey plan go America weda na for school, business, waka, or any oda reason.

Recently di United States Mission for Nigeria for statement bin announce sweeping changes to dia non-immigrant visa policy for Nigeria, wey reduce di duration and conditions under which most Nigerian travellers go fit enta America.

Dem announce say, "Effective immediately most non-immigrant and non-diplomatic visas issued to citizens of Nigeria go be single-entry visas wit a three-month validity period.

Dis move na part of one global reciprocity rearrangement, wey be sharp departure from previous visa terms, wey bin often allow for multiple entries ova two years or more.

For years, di US don issue Nigerians 5-year visitor visas and 2-year student visas, even though Nigeria dey only offer single-entry visas valid for three months only for those wey dey plan to visit di kontri from US.

"We wish to note say, as e be standard globally, visa reciprocity na continuous process and e dey subject to review and change at any time, such as increasing or decreasing permitted entries and duration of validity," di statement read.

"Di US non-immigrant visas issued prior to July 8, 2025, go retain dia status and validity," di statement add.

Dis reciprocity no apply to pipo wey get immigrant visa, na only for non-immigrant and nondiplomatic visa.

But di Di US Mission for Nigeria later come clarify say di reduction in visa validity no be becos of any kontri stance on third-kontri deportees, introduction of e-visa policies, or connections wit groups like BRICS.

Dem tok dis for inside one post for dia official X handle as dem address di recent visa issue.

''Di reduction in validity na part of an ongoing global review of di use of U.S. visas by oda kontris using technical and security benchmarks to safeguard U.S. immigration systems''. US Mission for Nigeria tok.

''We value our longstanding partnership wit Nigeria and we dey committed to working closely wit di Nigerian public and goment officials to help dem meet those criteria and benchmarks, wey go ensure safe, lawful, and mutually beneficial travel between our nations''. US Mission for Nigeria add put.

Source: BBC