Members of di Peoples Democratic Party [PDP] gada for Abuja as dem hold dia 102 NEC meeting
Di main opposition party for Nigeria wey be di Peoples Democratic Party [PDP] don zone di presidential candidacy for di 2027 General Elections to di south.
Di political party wey dey try to put dia house togeda make dis ogbonge announcement afta dia 102 National Executive Council [NEC].
Di meeting happun on Monday 25 August for Abuja, Nigeria capital.
Dem read di communique wey contain decisions wey dem make for di NEC meeting.
Di political party also appoint Iliya Damagum as di substantive National Chairman of di Party.
For di communique dem also tok say all PDP national offices wey dey for di northern and southern regions go remain as dem be.
And since di position of di National chairman dey for di northern region of di kontri di presidential candidate for di 2027 election go come from southern Nigeria.
Di party also announce say dia national convention go happun on di 15 and 16 of November, 2025 for Ibadan , Oyo State, South-West Nigeria.
Di NEC also receive update from di constitution amendment committee wey dem direct to circulate di draft to various organs and chapters of di party.
Dem also condemn how di ruling All Progressives Congress dey collect members of di party thru alleged mago-mago like manipulation and odas.
Wit dis NEC meeting e mean say peace and stability don dey come small-small for di Peoples Democrtic Party, especially as dem don get substantive national chairman.
Di zoning of di presidential candidate to di south na anoda step wey show say dim party don dey get direction.
Di next tin na to see how di National convention for November go waka.
Wetin dis NEC meeting mean for di party?
Since afta di 2023 general elections di Peoples Democratic Party neva rest. Na from one internal kasala to anoda.
Issues like substantive national chairman, national secretary, zoning and oda internal mata bin dey disturb di party.
Sake of dis issue many members of di party decamp to di ruling All Progressives Congress.
One of di members wey be Senator Ned Nwoko bin tok say PDP don scatta and im give reasons why di leave di party.
Delta State Govnor Sheriff Oborevwori bin also defect to APC wey mean say PDP dey lose dia traditional grounds
wit dis NEC meeting all di issues wey bin dey disturb di party don settle.
Ogbonge members of di party like Samuel Anyanwu wey take im place as National Secretary na ogbonge sign say peace don come.
Di question wey pipo dey ask na weda di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike support di decisions from dis NEC meeting sake of say di main kasala for di party start wen former Vice President, Atiku Abubakar bin win di ticket for di 2023 general elections.
Former Rivers State govnor bin para sotay e use vex put one leg for APC while anoda leg dey for PDP.