Menu

Peter Mutharika: Malawi ex-president wey come back to win election at age 85

Peter Mutharika Former President Peter Mutharika don win Malawi election by big margin

Thu, 25 Sep 2025 Source: BBC

Former President Peter Mutharika don win Malawi election by big margin according to official results from Chairperson of di Malawi Electoral Commission Justice Annabel Mtalimanja.

E get 57% of di votes, compared to di 33% of current President Chakwera, wey don concede defeat earlier in di day.

Dis announcement mark a major political comeback for 85-year-old Mutharika.

E serve as president from 2014 to 2020, wen e lost to Chakwera by a wide margin.

E dey inherit economy wey dey in deep crisis, with serious shortage of fuel and foreign currency for di southern African state.

Mutharika dey take ova from Dr Lazarus Chakwera wey bin lead di kontri since 2020.

Incumbent President Chakwera don already concede defeat to Arthur Peter Mutharika of di Democratic Progressive Party.

Inside im live speech to di kontri, Chakwera congratulate Mutharika for di electoral victory.

"From di official results e dey clear say my main rival, Professor Mutharika, don already secure ogbonge lead. For dis reason, I don call Professor Mutharika to congratulate am for dis historic win".

Chakwera also confam say im go court on Tuesday to try to stop di announcement of di results but im accept wetin di court tok say di electoral commission gat to go ahead and announce di results.

Chakwera also tok say "Malawians, whether you dey di winning or losing side, I beg una, make tins remain peaceful"

Bifor Chakwera become president of di kontri, na im be president of Assemblies of God church for 24 years, wey im decision to enta politics bin surprise many pipo.

Im contest di 2014 elections as candidate for di Malawi Congress Party wey im finish second, wey im win di parliamentary seat to become leader of di opposition national assembly.

Plenti wahala hapun for di next election for 2020 wey Chakwera carry di mata go court ova irregularities.

Afta di constitutional court order for re-run of di election, Chakwera bin win 58% of di vote to become di first opposition leader for di world to go on to win di fresh election.

But now, Malawi get new president – di return of ex-president Arthur Peter Mutharika.

Profile of di new president Mutharika

Arthur Peter Mutharika na professor of International and comparative law for di Washington University School of law wey bin serve as president from 2014 to 2020.

According to di Washington University, di new Malawi president bin dey associated wit dia university for more dan 46 years afta im join di faculty of law for 1972.

For 14 September 2009, dem bin install am as Nagel professor as im dey leave from di school to serve as member for di Malawi parliament wey im also serve for di kontris cabinet.

Oga Mutharika bin serve as advisor for im brother – Bingu Wa Mutharika, wen di pipo for Malawi elect am for five-year term as president of di East African kontri for 2004.

Di 85-year-old also be strategic advisor for im brother Bingu Wa Mutharika im presidential campaign.

For 2008, dem name Prof Mutharika as chief advisor to di Malawi president in charge of constitutional, legal and international affairs.

Dem elect Mutharika as Malawi president for May 2014 – im follow di footsteps of im brother wey dem re-elect am as president for 2009; even though im die for office in 2012.

Im get to hit di ground running afta im campaign promises

Ahead of di September 2025 elections, voters bin accuse di evangelical pastor Dr Chakwera and di former law professor Mutharika of "corruption and running family and friends" govment during dia term.

While Chakwera bin campaign to fix di economy and restore confidence in govment, Mutharika campaign on im record of infrastructure.

Mutharika im latest win dey come at a time Malawi 22 million pipo dey face 27% inflation, fuel wahala and shortage of foreign currency.

According to di world economic forum, Prof Mutharika bin serve as minister for Justice wey im later become minister for education, science and technology.

Im also bin serve as Minister of Foreign Affairs from 2011 to 2012.

Bifor im become president for im first term, im serve for parliament for Thyolo East from 2009 to March 2014.

Wit di fresh mandate, Mutharika go hope to unite im kontri pipo and 'fix di economy by cutting spending and reducing di kontri debt," as im promise during di campaign.

"Dis kontri spoil but we go rescue am. I don put tins in place wey go bring tins back on track," Mutharika tell supporters during campaign rally.

Time don reach now to begin di rescue efforts afta im don win di vote of di pipo.



Mutharika go hope to unite im kontri and 'fix di economy by cutting spending and reducing di kontris debt," as im promise during di campaign.



Bifor im become president for im first term, im serve for parliament for Thyolo East from 2009 to March 2014.

Source: BBC