Porn users faces fit dey scanned to prove dia age, wit extra checks for adults wey look young, draft guidance from Ofcom suggest.
Di watchdog don set out some ways wey explicit sites fit stop children make dem no watch pornography.
Di average age wey children first see pornography na 13, one survey suggest.
Explicit website Pornhub tok say regulations need collect "highly sensitive personal informate" wey fit cause gbege for user safety.
Privacy campaigners don also criticise di proposal to warn say "gbege" outcome fit dey if data from age checks dey leaked.
One big UK population dey watch online pornography - nearly 14 million pipo, according to one recent report by Ofcom.
But di easy access to online pornography don also raise concerns say children dey view explicit websites - wit one out of ten children dey see am by age nine, according to one survey by di Children Commissioner.
Di Online Safety Act, wey recently become law, require say make social media platforms and search engines protect children from harmful content online.
E go dey enforced by Ofcom, wey fit issue large fines if firms no obey.
Ofcom now don outline how e expect firms to dey "highly effective" to obey di new regulations, wey go come into force sometime for 2025.
Acceptable methods fit include:
Aylo, di owners of Pornhub, say dem back di principle of age verification but don voice worry about user safety and privacy.
"Any regulations wey dey need hundreds of thousands of adult sites to collect ogbonge amounts of highly sensitive personal informate dey put user safety for trouble", e tok.
Pornhub na di 14th most visited website for di world, according to statistics from Similarweb, but face serious allege for 2020 wey relate to illegal content on di platform.
Wen di US state of Louisiana bin start age verification, Aylo tok say Pornhub traffic bin drop for like 80 percent for di state.
But e say instead make dem stop to view porn altogether, users go instead to "darker corners of di internet wey no dey ask users to verify age, wey no dey follow di law, wey no dey take user safety seriously, and wey often no even dey moderate content."
Di company tok say for dia view age-verification need take place "on di device" - in oda words parental controls on phones and computers wey stop children to access pornography.
To use virtual private network (VPN), to mask di region wey dem dey located, na one way explicit site visitors fit try and bypass age-checks.
Simon Migliano, head of research for VPN comparison site Top10VPN.com say "For Louisiana demand for VPNs more dan triple while for Utah e surge by 847% di day afta di new age checks enta effect.
However, Oga Migliano understanding from VPN providers, na say "dis increased demand dey driven by adults no dey comfortable to disclose dia real identity while dem dey watch adult content."
Abigail Burke of campaigning organisation, di Open Rights Group say no enough emphasis on how dem go keep data safe for di guidance.
"Di possible consequences say data fit leak dey catastrophic and fit include blackmail, fraud, relationship damage, and di outing of pipo sexual preferences for di very vulnerable circumstances," she tok.