BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Police arrest Sean Kingston, mother afta raid of singer house

Screenshot 2024 05 24 123121.png Singer Sean Kingston

Fri, 24 May 2024 Source: BBC

California police authorities don arrest singer Sean Kingston, hours afta police raid im Florida mansion, dem also arrest im mama.

Na one company arrest Oga Kingston for February becos e no pay in full for big TV and sound system.

US media report say e dey custody for Fort Irwin, southern California, on fraud and theft charges on Florida warrant, according to police in di latter state.

Inside on social media post, Oga Kingston tok say im lawyers dey "handle evritin".

Earlier Florida police raid target residence near Fort Lauderdale of di singer - wey im legal name na Kisean Anderson - wia e dey live for court documents from February.

US media - including di BBC partner CBS News - report say di woman wey dem arrest na Oga Kingston mama.

Confirming di raid to di BBC, di Broward County Sheriff Office say e serve arrest and search warrants for di property.

"As result of di investigation, adult female, Janice Turner, 2/16/1963, we take am into custody on numerous fraud and theft charges.

"Dis investigation na active and ongoing."

Officers dey carry goods away from di house afta. E no dey immediately clear weda di arrest dey link to di company allegations.

Oga Kingston arrest hours later for southern California na witout incident, US media quote police. Di BBC don approach di Broward County Sheriff Office for further comment.

Oga Kingston and im mama, wey pipo for Instagram sabi as Mama Kingston, don also ask for response.

Bifor im own arrest, Oga Kingston appear to address di developments for im Instagram account.

"I dey good wit my mama," di singer tok in response to report say di woman wey dem arrest na im mama.

"My lawyers dey handle everitin as we dey tok," e tok.

Lawyer wey dey represent dem gree say allegations dey against dem, AP news agency report: “We look forward to addressing dis for court and dey confident of successful resolution."

Inside court document wey BBC see, Ver Ver Entertainment claim say Oga Kingston contact di company ova social media for September 2023 to buy one "232-inch Colossal TV, wit oda robust sound system".

Di company claim say oga Kingston "induced" di business to install di products wit "small down payment" by making "numerous false representations", including suggestion say e go create promotional videos for di company wit Justin Bieber.

Following di installation, di company say Oga Kingston fail to make di remaining payment and dem sue am for breach of contract and fraud.

Lawyer wey dey represent Ver Ver Entertainment tell Miami Local 10 news say di company dey hope to retrieve di items from im house following di police raid.

"We know say our property dey inside dis house right here, so as soon as di raid take place, we dey go get crew of pipo dia to reassemble am and take am back to im rightful owner."

Oga Kingston, 34, dey popular for im hit song such as Beautiful Girls, Fire Burning, and Eenie Meenie featuring Justin Bieber.



Fotos from by di BBC US partner, CBS, show say several police cars and large police vehicle near di mansion

Source: BBC