Plenti pipo seen dey follow Natasha Akpoti-Uduaghanas as e dey go office
Nigeria senator, Natasha Akpoti - Uduaghan wey dey represent Kogi Central Senatorial District don finally gain access into di National Assembly but e no dey clear if she go enta her office.
For one video wey don go viral on Tuesday 23rd September 2025, di video show wia di Deputy Director of Sergeant At Arms for di National Assembly, Alabi Adedeji, dey unseal di office of Senator Natasha.
Authorities for di National Assembly bin seal her office on 6 March 2025 afta di Senate suspend her for six months for misconduct.
All dis dey happun on di same day wey large crowd of pipo wey dey believed to be her supporters gada for di Federal Capital Territory [FCT] High Court, Abuja, Nigeria capital wia hearing of her case suppose happun to show her support.
Di supporters march from di FCT High Court to di National Assembly wia she finally gain access into di law making premises.
Una remember say on 22 July, 2025 Senator Natasha Akpoti-Uduaghan bin try to enta di National Assembly premises but security pipo bin no allow her.
Wetin happun for court
Justice Chinyere Orji suppose hear di preliminary mata between Natasha Akpoti-Uduaghan and Nigeria govment on Tuesday 23 September, 2025.
Dem bin adjourn di mata till Tuesday from di last sitting wey bin happun on 19 June, 2025.
Wia Senator Natasha Akpoti-Uduaghan plead not guilty to defaming Akpabio, Bello as court grant her N50 million bail
Di large crowd of supporters follow her march from di FCT High Court to National Assembly until she enta di premises befor police begin pour teargas to scata di crowd.
Dis dey come afta di judge wey dey hear di mata, Justice Chinyere Orji adjourn di hearing of di preliminary objection to 27 October, 2025.
Justice Chinyere Orji adjourn di mata afta counsel to Natasha Akpoti -Uduaghan, wey be Idahosa West tell court say di defence bin don file preliminary objection on di grounds of Abuse of prosecutorial powers by di office of di Attorney General of di Federation [AGF].
"Dis no be challenge to di elements of di charges as quoted, but na challenge to di validity of di actions filed. So dat assuming di court agree with us, need no go dey again to go further"
Idahosa say dem don serve di office of di AGF wit di preliminary objections on di 18th of September, but dem neva receive any response.
Im add say, wen dem dey go through di proof of evidence, dem notice say witness statement no dey and by law, di defence dey entitled to full disclosure of di witness statement in order to help dem prepare for di defence.
Idahosa explain say im tink say e day appropriate to hear di two sides argument as im urge di court to set date wey dem go hear di objection.
Counsel to Nigeria govment, David Kaswe tok say for di last sitting, dem bin adjourn di mata to Tuesday.
Im say dem arraign di defendant on 11 July - wey be clearly three months ago. So di defendant bin get plenti time to file any process including di notice of preliminary objection, but she no do am until September 18 wey be just last week Thursday.
Im say di office of di AGF no go fit act on document within di short period and minute am to di department.
Im add say di AGF no dey Nigeria now as im dey attend di United Nations General Assembly.
Meanwhile members of di National Assembly suppose resume from dia recess on Tuesday 23 September, 2025 but dem postpone di resumption date.
For statement wey di Clerk to di National Assembly , Kamoru Ogunlana sign wey dem release on Monday 22 September, 2025 wit di title "Reschedule of Resumption Date of Plenary Activities in the National Assembly."
Dem inform di presiding officers of both Chambers of National Assembly, members and di public say dem dey postpone resumption date to October, 2025.
"Resumption date of di National Assembly earlier scheduled for Tuesday 23rd September 2025 don dey postponed to Tuesday 7th October 2025. However, committee activities continue . "
How di mata start
Na for February 2025 kasala bin happun for di National Assembly for Nigeria.
Di kasala na between Senate President Godswill Akpabio and Senator Natasha Natasha.
Senator Akpabio bin give order to di Sergeant-at-Arms to carry Senator Natasha Uduaghan comot from di chamber.
According to local media, AIT di kasala start from wen di Chief Whip of di Senate, Mohammed Monguno, tell di Senate say Senator Natasha no gree relocate to di new seat wey dem give her.
Di Chief whip add say di reason why dem give her di new seat na to close di gaps wey di two pipo wey defect from di opposition create as dem join di ruling All Progressives Congress (APC) from minority party.
Senator Natasha wey bin dey 'visibly frustrated' accuse Akpabio say im dey deliberately silence her voice and also deny her di opportunity to contribute to motions.
Natasha match leg for ground as she tok say she no go gree make dem push her go corner.
She add say di worst tin wey di former govnor of Akwa-Ibom State fit do na to suspend her.
Natasha tok say even though dem suspend her, she go kontinu to serve her pipo for Kogi Central and di women of Nigeria.
Natasha sama accuse for Akpabio head say im dey "discriminate against her, malign, and dehumanise her".
According to officials of di Senate, Natasha bin break dia rules to disobey di order to relocate to her new seat.
From here, di Senate sama Natasha six months suspension but she tell Senate president Akpabio say, 'I no dey fear you.'
Since den, Natasha dey on suspension but she still dey do her tins.
She been go different media to tok about her case wia she also sama accuse of sexual harassment on Akpabio.
Recently, Kogi State goment bin ban gatherings ahead of her 'home coming' but Natasha still do am.
Pipo for her constituency bin wan recall her, but e no work as Inec fault petitioners recall process for Senator Natasha Akpoti-Uduaghan.